SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 17/04/2014. If person nor - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 17/04/2014. If person nor ask questions e nor go fit get answers. Na from clap nai dance dey start. Na wetin person get nai e take dey proud,so i dey use opportunity dey call on all Safarians most especially residence of Adeola Rd by New Rd,Ajimele Rd and Akpoisi Road to calm down and relax small,as i throway voice call give Chief Lucky Ayomanor yesterday due to the contineous neglect wey the Agency dey give the road. We go agree say rain dey come soon and with the reluctant wey and manner wey the repairs dey go so,e go definately enter rainning season and before den,we go suffer well well due to bad spots wey dey our major roads. With these assumptions nai make i call Chief Lucky Ayomanor,wey cum explain the challenges wey him dey face give me. My people our Oga wey dey incharge of the roads repair cum tell us say na shortage of funds nai dey worry the Agency wey make dem norva fit complete the said Roads and e even get am for mind to repair Reclamation Rd and Market Road,also Oboska lane and other roads within the town. According to Chief Lucky Ayomanor e talk say e nor dey happy with the way our Market Road dey becos dat na one of the major Roads wey dey under e care and immediately as money cum from the State say e go make sure say dem rush and finish the Market Road.Also e frown for the Reclamation Road situation becos e dey among pipo wey mount pressure give Hon. Julius Egbedi to clear the dirty wey dey along the Road but with d situation of lack of funds e norva fit start the Road as expected. He also promise to work on that Road as soon as funds come from the State. Chief Lucky Ayomanor cum talk say make we disregard any claim from rumour carriers wey dey talk around the Town say DLA don complete the Adeola Rd by New RD,Akpoisi RD and Ajimele RD becos dem never pour Hasfat and dat na one major factor wey dey disturb the work to completion now. When we come interview our Chief on the plans wey e get for other Roads,e cum talk say e nor get problem,say so long the money dey from the State to do Roads come say he stand to represent Sapele and e assure us say our Roads go meet up standard. He frown for those pipo wey dey throway dirty water for Government Roads as dat na one major contributing factor wey dey destroy the coation of the Roads. From our studio we cum beg Chief well well becos Politicians mouth dey sweet well well wen the money norva cum but when money don touch deir hands finish na different matter we dey hear. As usual we throway words give am say we nor go hesistate to publish e neglect if we find out say the said money come and the listed roads nor benefit from am. From our studio we challenge the slabs wey dem use do that Adeola Rd as the slabs too small,but Chief talk say that slab na up to standard as e personally don supervise the work to see say the slab go match d test of time. If dem send pikin message e dey good make e bring report from the message. So dis na the message wey unu send me and na the report nai be this. I see say many of us nor dey bold to ask most of our leaders questions and becos of that things dey spoil and some projects dey de stagnant becos dem feel say we nor get voice and mouth to challenge deir public offices. Na with dat issue nai wake us up to dey do this work so that we go dey get feed back and dey helep dey check deir excesses to know who dey try and who nor dey try. Na me the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. Oya make we reason wetin Chief Lucky talk weda e make sence or not? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 17 Apr 2014 06:21:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015