SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 31/05/2014. Dear Hon. Ben - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 31/05/2014. Dear Hon. Ben Igbakpa. My very good friend Ben clap for yourself...you think say u go just go on air dey promise wetin you nor go fit keep abi? I remember when you helep your Oga steal money go U.k,along the line nai God expose unu two,nai you convert the money take buy Buses wen give birth to Delta State Transit. Today your own na to dey throway special words to back the Government against the people wey put unu for offix. The other day you promise us say u go put Buses wey go dey run Inter State from Ughelli,Warri,Asaba and Agbor to Benin in particular and other states but up till now you throway face becos dat nor concern you and ur Ogas dem becos unu nor dey enter Transport. The other day unu beg our studio to helep unu announce say Federal Government Intelligence dey the town dey search young people cars as dem dey over dey use big cars without better job. If i say make i ask you Hon. Ben Igbakpa say amany cars you get? I nor sure say you go fit answer the question becos you load Brand New Cars full ur Car parks and you still dey buy more. To d extent say any Abroad person wey cum with high class of car na u be the current Political Alhaji buy anything. How long you go dey like dis? You don shift ur investments go Warri so dat u go dey fit dey steal from the state well. Na only ur family people nai and ur Inlaws u dey helep as others be like shit for ur eyes. The truth be say i nor fit fear you make i nor tell you d truth. Where you dey stay pipo around you nor fit feel ur importance as leader becos u nor care weda dem dey exist. Your light and deir light go go off,but when you wan repair am,na only your own you go think about. As u dey intentionally dey sufffer the pipo for d area. You need to fear God becos your end for power dey close. Make you nor feel say dis na last regime wen only one man go prison for unu head,dis one dem go pack many of unu go Jail. You and your wife don turn over night landlords for many compounds and lands for Sapele. You even go far go buy the vast land wey ur wife store dey. As you battle with Ejele buy the land (for dis one i nor blame you but na d Okpes wey dey sell all deir rooms nai i blame). For the numerous houses and lands wey unu dey buy make unu know say we go retrieve all wen Govt power go commot from unu hands. Make i ask you where Gadaffi and Mubarak today? Honourable good name better pass wealth. Make i tell you all those Cars and Houses wey u and ur wife dey buy follow everywhere go liquidate just now. Just to talk nai make you throway comment say make all those people wey dey hold Transporters vehicles and Okadas say make dem nor dey collect money again and u nor put special Task Force to enforce d law,becos e nor concern you. Since wen you give dat order dem still dey sell Tickets for Sapele and other places as dem dey even dey hold pipo wey nor get tickets. I dey vex for you in particular becos na only d issue wey concern ur pocket nai u dey take serious,why d masses own na rubbish becos na we fit suffer. You don turn your Delta State Park for Okpe Rd to where dem dey abadon Vehicles put. As buses full dere reach na only two abi three buses dey work. If d office too big for you make u drop am becos i norva see one single innovation wey u bring to helep d masses reduce stress of Transportation. Your wife own na to dey open stores for all e sisters,why you dey helep the Government dey carry money go drop for UK. Make i nor too talk but if u know wetin fit you just correct all ur wrongs now becos i go revisit your office again and i go helep you publish the evil acts wey u dey commit and i promise to post the amounts of money wey you dey carry dey go abroad dey go keep becos vacuum full your financial records. Make i run go do my convocation for Delsu first. (Hon. Henry Ofa you be next oh). The Otota1 of Sapele don talk. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes of Delta State. God Bless Sapele. BEDC cut our studio light becos of N68. Na wa. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 31 May 2014 07:43:16 +0000

Trending Topics




© 2015