SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER GODS TIME NA THE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER GODS TIME NA THE BEST (Dedicated to all talented and gifted ladies in sapele) Until garri enter hot water, e nor go change e name. Pinkix na twin wey papa die leave for mama to train alone. Unu know say for this country now, and the way life be today, woman pikin wey say she nor go, go school or learn trade or acquire stills, nai be say, she use her life take plant mango for road. Na the importance of education nai make Pinkix say, she must become a graduate. True true, God come do am say she finish her school with a good result. Even her twin sister come still finish, get work with one International Magazine Company for Lagos after she don marry. But Pinkix wey be senior, still dey d street dey find work. Though, she get very good talent becos she sabi write and sabi sing. Dem say, na when hungry beat person nai e dey remember e talent. That time when she dey school, she don get some unpublished works say when God bless her according to plan, she go publish the books. To keep body and soul together, she come dey teach for one private secondary school. Na one Friday evening nai she go meet one of her maternal uncle wey dey work for ministry of education for Asaba. Uncle Aby come call her enter him guest room come drop #100,000 for table say the only way he go fit help her achieve her dream of publishing her work wey she titled SMALL YANSH, BIG SHIT Na for her to let am dey straff her steady becos say she be fine girl with good shape. E come even say when he publish the book, he go use him influence take make sure say dem use the book for Delta State Schools. Pinkix stand near the bed, her eyes dey look the money, her uncle and she look herself. Her mind come go how she go take become popular if at the end dem publish her book and come use am for school. But instantly, she remember wetin her late dad tell am Every woman get price wey dem dey pay for her pride and dignity. But the most expensive woman for life na d Priceless woman. Men nor dey quick dey buy them. But those wey finally fit afford dem, nor dey joke with them at all As she remember these words, na so water come dey commot from her eyes. True true, e easy to talk say make person nor sell her body, but e get how things fit be, na only your body go sell you. Pinkix dey cry as she dey pull her pant say all die na die. All sin na sin. Na where she for the pull her tight nai one voice echo My daughter, why u dey give up on me your God? I promised you say you go become popular, u nor believe. Nor think say me go bless you through sin. U nor believe me, na human being u wan believe? Come on, leave this place. I will not forsake you She turn and ask her uncle, Uncle Aby, why you say make I go? But Uncle Aby say e nor talk anything like that. Na where her conscience for dey reason the matter nai she know say na God talk to her. Na so she take wear her pant commot from the guest room even when uncle Aby dey call her. Outside d hotel, she just stand dey imagine wetin she wan do before. She come go church that night go pray for altar say make God forgive her. Where she for dey sing dey cry, nai d pastor come pray with her. As she dey wait for bike, one jeep come park for her front. The driver dey try to find him way to TM hotel. Where she for dey describe the place for the man, nai d man ask her if she be singer, becos her voice dey very sharp. Like play, the man na one of Ovie Ofugara guys wey dey work for notjustok, called Brown. That internet pipo wey dey promote Nigerian music artists. Play play play play, the man come promise to meet her go do LP for her and do small video for her by Monday say God tell am say she be superstar. After the marriage wey d guy come on saturday, d guy come invite her come e hotel. With him Z10 nai e take video her as she dey sing her own song THE LORD IS GOOD The man come tell her say make she choose name wey she like to bear for the purpose of singing. She come say na Pinkix wey her late dad dey call her nai she like. PinkiX continue her work for the school. December period, when dem for dey prepare for send forth for their school, na one of her co teachers run go meet her for staff room Pinkix! Pinkix!! Dem dey play your song for cool Fm Na so she put one of the ear piece for her ear. As she dey hear her voice, na so she dey jump Na me! Na my song She come dey sing along till the song finish Immediately nai her phone ring. Different calls from everywhere. Dem dey tell her say cool fm play her song. At the end of the party, she sidon for house with her mama and sisters. Dem wan watch Dumebi the dirty girl. Her mama come tell Pinkix make she change the television out put becos na Sound city dem dey watch before for cable As she carry the remote dey press am, e nor dey answer. Nai her mama say make she change the battery. She waka go room go bring battery. As she dey change am, nai be SPANKING NEW VIDEO wey dem show for sound city. Na her Video nai dem come dey play. As her mama see her for the tv Pinkix. Nor be u be dis? The sound of the song make d remote fall commot from her hand. Where all of them for dey happy dey watch the video, nai be Brown wey call her Take flight to Lagos in the morning. I go send you #50,000 in the morning and I go dey airport dey wait u. Send me your account details She faint when she hear wetin Brown talk. If film too long, e go get part two. Na so she take enter stardom. And Brown come marry her at last. MORAL: 1. The worth of any woman na the price she place on herself. 2. Anybody wey get talent be like oil wey dey land, oil company go locate am. 3. God nor dey forsake good person. 4. Nor sell your pride becos of money. 5. When God remember you, you yourself go fear d way things go take open. 6. Water wey person go drink nor go pass am. 7. Becos say person papa die nor mean say u go turn ashewo. 8. When u see strangers, help dem cos u nor know who dem be. 9. Everyone get e time. 10. God nor dey bless person through sin. PRAYER Make God give us d grace to stand firm and wait for am for our life. Amen. I dey go Lagos dey go find Pinkix CD buy. Dem say e norva enter sapele. Before december, I go don trek pass Ore. SAPELE/DELTAE STATE MUST BETTER
Posted on: Fri, 17 Jan 2014 15:13:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015