SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER NOR DRIVE IF YOU DON - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER NOR DRIVE IF YOU DON HIGH Great pipo of sapele. Prevention is better than cure. Make we all be careful this period. Make we all be careful o because life nor get duplicate. I dey talk now becos if you nor be careful, things fit spoil pass wetin dem fit repair. I carry my agogo come outside becos of the rate at which accidents dey happen for this town. Accident wey dey happen mostly for this town now na as a result of drinking. Yes. Some of us dey abuse drinks wella for sapele mostly during the weekends. Drinks na for 1- Relaxation. 2. Celebration. 3. And sometimes for digestion and medication. When we meet some friends, or after the hard days job, or during a meal for house or even sometimes when we dey down with troubles of life like death of our loved ones, heart breaks from our lovers, divorce, lack of money, we go see say drink dey play some kind of positive roles. E go make us forget our problems for that particular time or hour. Pistol nor bad. Na who carry and wetin dem use am take do na go make am bad or good. Now, drinking nor bad. But na d way and manner we dey drink nai bad. All the guy men wey dey this forum, make unu read and learn. After unu don learn, make unu pass d message to unu pipo. In those days, wen our parle don enter bottle, na trek dem dey trek go house. Some go fall for gutter. Some go shit for body. And some go sleep for bush. Dem know say dem dey go high, so, dem nor dey carry their bicycle dey go there. Either dem slab or dey take transport. Na there you go see children dey use dem play by the time dem don dey maga for road. But our men of today, wen dem wan go high, dem go carry their motor wey dem manage buy. Take hone take control men say dem dey so so so joint make dem show. And true true, babes and men wey like ojofri go fall in. For their present, their padi go down one bottle, two bottles, three bottles dey go. By the time wey e don high, e go manage settle the bill come enter motor dey drive go house. My pipo, many of them nor dey reach house. So, as a good man and woman, make we dey do the following things if we know say we wan go turn for throat. 1. Nor carry your expensive phone go drinking parlour go shark. 2. Make sure say you get one padi by you wey must not enter bottle so that when e red for your side, e go stand for you. 3. Nor drive go drinking parlour alone cos you fit high. Make sure say person dey with you. And once you don soak, make that person collect your car keys drive you. But if the person still high, make unu nor drive the car. Make unu just trek. At least, before next year, unu go reach house and unu jonsing go don clear. Lolz. 4. Carry only money wey you want take buy shark go drinking parlour make guys nor go clean you when you don high. 5. Tell one person at least where you dey go in case something bad happen. This period nai bad things dey happen pass. Make we avoid the once we fit. Wetin dey sweet goat nai dey kill am. Prevention is better than cure. If you say e nor concern you and you nor wan advice dem, by the time dem don high, e fit be say na your brother or sister dem go go get accident with. Make we do things small small o. Devil dey sleep. Make we nor go wake am o. Na beg I dey. Just say No to driving when you don high. My good pipo, I nor wan cry again becos say one sapele pikin die for accident becos of drunkeness. Abi unu want make army dey stand by for drinking parlour now to monitor pipo wey don high make dem for nor drive? Na question o becos I dey see say the way many of us like shayo, nor dey make us get sense. Make I go clean my hunter gun. I wan go Ajemele go kill elephant. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Mon, 25 Nov 2013 14:49:50 +0000

Trending Topics




© 2015