SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER! Some weeks back from our studio - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER! Some weeks back from our studio nai we list Roads wen we need to repair give Chief Lucky Ayomanor,and he don attemp most of the Roads,especially the ones wey lead to major outlets for the Town e.g Amuogodo, Olympia, Adeola before Crudas Junction,Owumi,Abeke Rd by Texaco,Commercial Avenue,Akintola Rd,Otite Rd e.t.c. All here na where Chief Lucky Ayomanor don use him efforts take repair unbehalf of the Government,make we CLAP for Chief Lucky as e dey listen and dey work according to our complain compare to some other Stakeholders wey sit down press Sapele Growth to deir own interest. We throway complain enter Seplat as dem dey use Gana Road and Ugberikoko Road and d Road bad well well,beyond our patience,we cum write deir Oga Letter and tell am say na our responsibility to challenge dem to amend the road for us,as part of deir Social Responsibilities. Dem come agree,as dem waka round Hon. Monday Igbuya wey cum helep seek permission to do the Road. According to one of our report Seplat cum award the Contract give one Company. Wen we hear d matter we cum smile,but along the line the Company nor show interest again. Wen i call Chief Lucky Ayomanor i cum see say he done ready to do Gana Road,but becos of Seplat interest to do the Road,me and am cum discuss say make e withdraw from the Road,so dat e go fit focus on other Roads for the Town. As we talk,na so Chief cum do. But we nor cum see the Company again for site,to do deir work. (MEANING SAY SOMETHING DEY WRONG SOME WHERE) Yesterday nai i see say DLA done resume work for Gana Road,wen i call Chief to ask am,how d tin cum happen,he nor pick. I assume say he dey busy. (Chief next time send me test or i go vex for you). Weda na d controversial call wey we get some days back nai make you ignore my calls,i nor know,but one thing wey u must know be say,as the OTOTA1 OF SAPELE, i nor dey compromise my sincerity against my people. I know say Governor increase unu budget well well and from dere nai unu buy enough Machines and Material to take dey work,but dat nor be enough reason for some bad eggs not to divert the Cash to deir personer pocket. My people,i know say some of unu nor know dis Chief Lucky for face,very soon we go upload him picture as one of our reliable son wey dey the Government by appointment and he dey work well to the benefit of the Masses through our candid suggestions. THE OTOTA 1 OF SAPELE. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. THE URUKPE 1 AND THE VOICE OF THE VOICELESS carry yanch up take salute Chief Lucky Ayomanor and Delta State Government. Nor be only bad tins we go dey expose,we go also show proper appreciation to anybody wey worth our regards. Chief Lucky we go mark you good if you do that Gana Road go reach Ugberikoko ending. My people na here i talk reach dis morning,i hear say people dey find me for d town,becos of yesterday list hissssssssss. I DEY OLYMPIA WITH 40LITRE OF FUEL AN MATCHES,MAKE UNU CUM. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 24 Jun 2013 06:10:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015