SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER YOU FIT FIGHT FOR LOVE? Linda - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER YOU FIT FIGHT FOR LOVE? Linda dey bike dey come from market that Sunday morning wey she go buy gbogbo. As the bike just bend enter Azigbo lane from Ogodo road extension, nai be her younger sister, Mercy wey she see dey cry and dey bleed for many places of her body. Crowd full the place. She come quickly come down. Pay the bike. Two girls wey wear bumper shorts nai dey fight her sister so. One hold wood, the other one carry knife. Her sister carry one small stick for hand dey jump anyhow as dem dey beat her like winch wey dey break. From nowhere nai Linda root one iron pole. Befor the girl wey hold knife know wetin dey happen, nai be kpwoa for head. Na so she fall flat for ground. Everybody wey dey shout Ashewo! Beat her! All of them come run commot from the place leave the girl for ground. Even the second one sef wey hold wood still run. Where Linda for hold her sister hand make dem dey go, nai be two guys wey rush go hold dem. Where unu dey go? Unu must carry this girl go clini go treat. Nor be unu sabi fight? Befor we know, Mercy don dey cry o. Linda come stop bike, nai dem rush the girl go Akwara clinic for Macpherson. God do well say the girl nor die. But her head tear like orange wey small pikin use razor blade take peel. Later that night for dem Linda House, nai papa Linda dey ask him children wetin cause the fight. Becos na almost #10k nai e spend for the girl treatment, he come dey paracin. E come ask Linda wey be senior say wetin cause the fight. Linda come dey scratch head. Her eyes dey ground. Nor be you I dey ask? Their papa come shout for her nai she say Papa, I nor know why dem dey fight o. I go buy something for market dey come nai I see them dey beat Mercy. Nai I follow dem fight o. The papa shake e head. So, you nor know why pipo dey fight but you come shook hand put nearly kill person abi? She qiuet. Oya you, Mercy, wetin cause the fight? Mercy plaster like deaf. Nai de papa lock the door. Stand for Mercy front. I say, wetin happen wey make dem dey fight you? Fear come grip Mercy when see say her papa eyes don red. Hmmmm. Papa, na Janet. Who be Janet? The one wey wound so... She say I dey friend her boyfriend. Nai she carry that her other friend come fight me for house. The words ring for Linda ears? Na boy friend matter? Nai their papa say make she shut up there. So, na becos of boy nai you wan let me kill person abi? Linda come dey vex. Mercy carry head for ground as their papa quietly sidon with shame. Nai e turn face Linda... Linda, na you senior for here, but you nor get sense. Befor you pull out a sword to fight for your person, make sure say you know the reason why you dey fight. Nor be every fight dem dey put body. When Jesus captors come catch am, Peter wey be e disciple come pull out him sword say e warn defend him master. But Jesus come rebuke am make e stop. Every fight get purpose. We fight for Honour. We fight for fame. We fight for victory. But nor fight for shame. We fight for love. And we still fight for Gods grace. The kain fight wey unu fight today na fight of shame. Some pipo dey fight becos of papa property. Some dey fight becos of man, woman, boyfriend, girl friend, husband or wife. Some dey fight becos of positions. Some dey fight for election. Some pipo dey fight becos of money. And some dey fight becos of one misunderstanding or the other. Nor be all fight good to fight o. Remember say, God and Devil fight. So, when you wan fight, make sure say you dey fight for a good and just course. Nor be fight wey person go hear e go come say you nor get sense. My pikin, nobody dey above mistake. But make I ask unu this question, E good to fight becos of love? As in physical throwing of punches and slaps. Nor be the use of jazz o. Oya, make we share ideas becos even the white book say, Since the days of John the Baptist, the kingdom of God dey suffer Violence and na only the violent pipo go fit take am by force. So, if another man or woman dey wan take your love from you, you go fit fight am? Husbands. Wives. Bachelors. Manchelors. Spinsters. Ladysters. Unu go fit fight becos of unu love? Yes. Or NO. Nor explain. I dey go buy adigi jollof for Sizlers take eat my frog pepper soup wey my wife cook for me. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 17 Apr 2014 15:26:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015