SATURDAY 16TH WEEKEND AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

SATURDAY 16TH WEEKEND AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOOOOO......... Make una no vex for the news wen we no post yesterday, na bcos say our subscription finish and na MB we come later dey use so to make sure say una dey updated, abeg make una no vex.............. Thursday wen suppose to be colour riot day, dem come shift am come yesterday as na cultural day dem come do as the place dey cuturalful and traditionaful, at least today I enjoy waiting I see no fighting na magomago for this one.............. According to our reporter from inside the hostel he tell us say na the boy wen troway him neck chain and shoe nai win the MR POLY while the girl wen win am nai say Hospitality management dey campus 1 instead of Applied science, so make una know say na complete 2 olodo nai dem give Mr and Mrs poly, hmmmm money go kill una for this school oooooo and things must change as far as Auchi poly tafia is concern, if not we go begin call name anyhow here not regarding who u are for dis school, make all of una for this school compose una self ooooo............. Yesterday bawark night for D Cape hotel for 2nd bawark make sense as dem come do mr and mrs bawark with other variety but na the gate fee nai come pursue people as na 500 naira dem put am but the party dey peaceful as congooo full ground to maintain law and order............... NIFES fellowship dey organise their praise night on the 21st of this month for the church auditorium make una no miss am ooooooo........... Fight burst yesterday for blessed lodge for 2nd bawark wen 2 girls stab each other almost to death bcos of food issue and na so one of the girl mouth open and dem come later rush them go hospital, hmmm make una leave fight ooooo e no dey pay............. Yesterday jean carnival for favour garden was peaceful cos fight no happen and girls full ground we thank God say e dey peaceful.......... Yesterday nai be colour riot day as hostel make sense die as different hostel begin dey match out with their different colour of dress, we finally give God the glory for the successful polyweek wen don finish yesterday............ Sugar girl and Okponku dem don suspend dem due to some tory wen we go give una tomorrow.......... Report don reach us say dis year SUG election na campus 2 nai wan host am live and the manifesto go still be CAMPUS 2 so make una ready oooo d date na 21st and 22nd wen be next week ooooo.............. We carry our big ear dey waka nai we here waiting dey happen for inside ASOB, as dean want make he department wen be public admin win ASOB president, on thursday dem hold meeting na so dean come dey tell mr Monday say na pub admin he go must give the president to, but me Tafia dey stand for the student and we no go fit allow dis thing happen and for this thing not to happen we dey beg una to vote this person wen we don choose say he go fit work well and I still know say nai una go still like choose for ASOB he name na FREEMAN, VOTE for am as president, cos me self don already vote for am............ This na exactly wan SUG Aspirant send to us yesterday and he name na SANTA dis na waiting he talk, Help me tell nigeria studen say by the grace of God if i win i go make dem kw say the SUG member dis year no try at all we go make change for for the poly them go enjoy our government cos no be only me go dey there,by GOd grace i go make my impact show i beg una make na try vote for Santa+ 2014 for SUG i beg, abeg make una give am a trier to so dat we go see waiting e go fit do for nigeria students me myself I go vote for am live............. TAFIA SATURDAY 16TH BIRTHDAY LIST: 1 Abdullahi Abubakar. 2 Rotaractor Miracle Emanuel Milo. 3 Austine Omorogieva. 4 Shaibu Patience Utewn ojo. 5 Raymond Brown chocolateboy- noni. 6 Sean Moses Okonofua. 7 Don vaser. 8 Sidi Abdulkareem. 9 Maleek dessy. 10 Edobor Osarugue Austine. We wish una long life with many money and sound health...... Report take plane fly enter our studio say dem don mark the post UME result finish but dem never ready to paste am yet due to say HND never write their own, hmmmm make una go help una self na ooooo with who una know ooooo before dem go paste am ooooo, who get ear make he hear............. HND form go come out on monday 18th of august and na fedelity bank, eco bank and unity nai go sell am respectively, the amount never come out for now till on monday, and make una know say Auchipoly na dey take pass oooooo na lower, upper and distinction dem dey collect ooooo............. Spat result don almost ready as some department go begin paste their own as from on the 26th of dis month so make una take note............ School fees still dey on but make una know say e go soon expire ooooo as na on the 31st of Auhust wen be dis month nai e go take expire........... Today MUYI park full as student begin go house for the week end we wish all of una safe journey going and coming in jesus name amen....... Muchi street Goat competition go start today for back of Shekina glory lodge as the place just 2 make sense die, make una go watch oooooo.......... If you know say u dey context for any of the SUG post make u inbox us the thing wen u go do if u win so that we go interview u and choose who we go bring e name out here for students to vote for and make una know say about 30,000 students plus nai dey see dis news everyday so if u b aspirant make u inbox us waiting u go do for Nigeria students if you win between now and saturday 12pm..... Take note............... Report reach us say our SUG don complete their project wen rector wan commission before them comot and the project nai be those plastic chairs wen dey Abso base for near Girls cafe, hmmmmm Sado na rubber chair nai b d project wen una take almost 2 million do eh, Tomorrow I go face una well just dey wait............. Our tomorrow news go show face around 9am and e go be base on our school SUG and their wahala and also those wen dey wan newly enter the SUG sit waiting dem get to tell una and lastly d issue of SPAT wen dem dey punish for this school so make una no miss am oooooooo................. Abeg we go need more groups to add us to their group so far we get about 35 groups wen we dey post news to and all together amount of students na about 35,000 plus so we still need the following group to add us, 1 business admin group 2 SLT group 3 Engineering group 4 OTM group 5 Pub admin group 6 Banking and finance group 7 Food tech group And many more to come abeg make una add us so dat the news go dey touch everywhere for the school and for Nigeria at large............. Abeg for those endowed students wen God don bless abeg make una help us to subscribe our system with any amount of recharge card MTN only to our inbox and make una know say God go richly bless una in jesus name amen.......... Ebola don dey spread ooooo as d latest news wen we hear b say the virus don enter Enugu and even Edo state governments don build facilities dey wait for am in case e reach here, my people no be so we talk am before oooooo, God abeg come save ur children oooooo........... If you read this news today make u say 20 seconds quick prayer to God, so dat e go protect u and ur family from this Ebola virus. I pray for all of una wen read dis news today say Ebola virus no go come near una household in Jesus name AMEN............. Abeg if u know say dat prayer na for u make u say or comment a big AMEN for big later word make God know say u serious ooooo abeg make sure say u comment Amen cos e get why............. NA ME TAFIA THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY. Nai dey bring una dis news. Abeg make I travel go sapele go take blessing from my earthly mentor SAPELE TAFIA una bye bye...........
Posted on: Fri, 15 Aug 2014 22:32:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics



Ece

© 2015