SPORTS TREK 2/5/2014 We don land today with boku Sports tori - TopicsExpress



          

SPORTS TREK 2/5/2014 We don land today with boku Sports tori we get weight as dem consin both Europe, Africa and Sapele. Chelsea shit prukutu as Atletico Madrid tap betta ball wey carry ogbonge counter- attack to bulala Chelsea 3-1 for d Champions League semifinal secon-leg for Wednesday as dem con set up all-Spanish final against dia city rivals Real Madrid. Na goals wey come from Adrian Lopez, penarity from Diego Costa and Arda Turan con give Atletico 3-1 aggregate win afta last wik goalless draw for Madrid and con put dem for d final of Europe ogbonge competition for d first time since 1974. Chelsea con begin dey lead afta 36 minites wen former Atletico favourite Fernando Torres waya goal wey con wake up d La Liga leaders wey go jam dia neighbours for d first European final to show two clubs from d same city for Lisbon on May 23. Na Chelsea midfielder Willian wey helep dem with de kain waka wey e do to grab d opening goal as Cesar Azpilicueta set up betta chance for Torres wey waya d goal. Atletico bin take advantage of d poor defending of Chelsea and con ekwalize one minite befor haf-time wen d home team no fit clear d cross wey Thiago give Juanfrian wey nobody dey mark, e con cross d ball to Adrian Lopez wey waya ogbunigwe shot inside d net. Veteran Chelsea kipa Mark Schwarzer con save two goals from Turan wey bin take advantage of more poor defending to faya many ogbunigwe shot. Atletico wey hold d away goal advantage with d 1-1 score nor relax sam sam as dem con get luck afta one hour wen Samuel Eto’o wey replace Ashley Cole con use e badluck tak foul Costa and chop penarity. Costa con faya d ball pass Schwarzer to make d score 2-1 befor Turan con use imekpe and concry take cement d beta win with d third goal as Chelsea nor see road again sam sam. From there, we con enter Wado-Wado bush market motor take land studio to tell unu say, Two ogbonge clubs wey dia name be Sevilla and Benfica don carry dia bag enta d final for dis year Europa cup afta dem kwalify last nite. Walahi na Spain get mouth pass dis year as unu know say na Real Madrid and Atletico Madrid go also jam diasef for d champions League final. Na Benfica carry second last year becos na dem Chelsea take carry d cup and na 2-1 nai dem hama Juventus last nite afta dem been don follow dem play 0-0 for d first leg. De koboko wey Benfica take waya Juventus pain dem for body well well becos na for dia house (Turin) nai dem go take play d final match on May 14. Na d goal wey sabi strika Stephane Mbia score for d mortuary time nai helep Sevilla kommot Valencia for road as dem follow dem play 3-3 for d two match. Sevilla been don win d first leg match 2-0 for dia house. Sevilla coachi Unai Emery wen get Okpe Origin according to e name, con dey dance like pikin wey carry first for school sake of say e boys don enta d final of d Europa League. From there, we con carry our kabukabu land Africa, Nigeria to be precise as FIFA wey na dem be d pipo wey dey control all football mata for d world don tok say dem must investigate how Naija take kwalify for d 2010 world cup wey hapun for South Africa. One agbero man bin don dey shout like pikin wey dey find e mama say na him helep Naija kwalify for d 2010 world cup. D guy name na Wilson Perumal Raj and na so d man write am for d yeye book wey e publish last week say na him sabi how e take helep Naija and Honduras kwalify for d 2010 world cup. D man even add join say na some NFF Oga dem been dey beg am dat time say make e do e best to helep Naija kwalify. “My belle sweet me becos na all my plan work for Naija as I helep dem kwalify for d 2010 world cup,” naso d ekpa guy write am for e book. Wen our studio troway interview give Oga amebo for d NFF pipo, Ademola Olajire nai e con yarn us say FIFA don tok say dem go investigate d mata well well. D Supa Eagus of Naija kwalify for d 2010 world cup afta dem use outside broom take sweep Tunisia, Kenya and Mozambique comot for Road. From there nai we use AGWOR OKADA take enter Sapele as some sports pipo don troway appeal give Sapele Girl wen dey represent Naija for World Ontio marks, get set, go! wen Oyibo dey call Atlectics and her name na Blessing Okagbare. Dem say make she try get fan base for Safi so dat she go dey helep pipo wen get talent like her to gain their talent fast so dat we go fit get many pipo wen go dey helep Nigeria to dey tear gas fast fast, for d world stage. Okagbare, oya nor forget where u for dey come, oya use ur influence take stage one local race competition for dis town. From there, na so we go end am for today. Make I go pay for my DRTV subscription wen go allow me to dey gada all d sports tori for dis forum. IF U WANT MAKE DIS SPORTS TORI DEY CONTINUE FOR DIS FORUM, OYA HIT D LIKE BUTTON. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 02 May 2014 15:55:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015