*SPORTS TREK World Cup Ekuñékú *Oga coachi for France, - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK World Cup Ekuñékú *Oga coachi for France, Didier Deschamps don gada plenty tafias for Brazil talk say he boys no dey fear Germany at all even though na beta ball nai dem dey tap for dis year World Cup. Today na today for d Maracana Stadium as France and Germany go jam diasef for d kwatafinal for d World Cup, and d true for d mata be say plenty pipo tanda for Germany back pass France. “Why we go dey fear dem? Dem go plenty pass us for d field or na two head dem get? we no dey fear anybody and we go show dem pepper. “My mind nor dey shake at all becos I know say my boys nor go fall my hand, and na all of unu go see how we go take wound Germany,” dis nai be d word wey d coachi yarn our studio. Since 1986 wey West Germany don waya France 2 kondo for d World Cup semifinal nai France don dey vex say na must make dem revenge. Na Naija nai France kommot for road take enta d last 8 afta dem waya d Supa Eagus 2 zero for dia lass 16 game. Germany eye red well well for dia own last 16 game bifor dem kon bulala Algeria 2-1 for dia own win or waka match wey shelle dat on Monday. * Brazil skippo for dis year World Cup, Thiago Silva don talk say nothing dey happen even as plenty pipo dey yab dem afta dem bulala Chile for dia last 16 game. D kain pressure wey dey Brazil playas head nor be small thing as unu know say na dem dey host d 2014 World Cup. “All of us dey kampe, becos we dey do d thing wey dey sweet us for belle. D kain pressure wey dey ontop our head for our last game against Chile na die, but we tank God wey helep us win d match,”. na wetin d PSG defenda yarn be dat. Brazil go enta d same trouser with Colombia for dia kwatafinal game on Friday, and Silva talk say na must make dem skatta Colombia. “Na d kain ball wey we dey tap nai Colombia dey play too, but water go pass garri for dem wen we enta field on tonite,”. * Our sport studio troway interview give Naija coachi, Stephen Keshi and he don open he mouth dey yarn our studio all d kain kasala wey he eye don see since d day wey he become d Supa Eagus coachi. Oga Keshi talk say na so,so palava nai he eyes dey see everyday as he add join say d NFF pipo wey dey control all football mata for Naija nor dey do am beta at all. Walahi, na like husband and wife nai Oga Keshi take follow our correspodent sitdown talk for Brazil. Oya make unu read wetin he yarn below- “Bros, I don taya for all dis kain politics wey dey for d national team, and I dey carry my bag dey waka “De contract wey I get with d NFF don kpai, and as I dey follow you talk now, nobody don yarn me anything as per d mata wey mean say dem nor want me again be dat,”. As we Tafia for Brazil con see say Oga Keshi wan talk all d thing wey dey for he belle, naso we kukuma con dey take style dey wine am, and naso d man con dey vomit. “I dey even hear some pipo wey dey talk say na becos I wan sell some playas nai make me carry dem enta Brazil for d World Cup, but na laugh I just dey laugh becos those pipo nor sabi anything. “If I nor carry Babatunde enta Brazil for d World Cup, how unu go know say d guy sabi tap ball? Abi nor be all of unu dey hail am for d beta ball wey he tap for Naija. I don follow all my playas talk say I dey go, and anybody wey go be d next coachi go carry on from where I take stop,” naso Oga Keshi talk. We con ask am say wetin go happen if Naija presido talk say make he nor waka. “Walahi, I respect d presido well well, but dis one go hard o, but make we just dey see how d mata go be. “E don reach 2 years and 6 months now wey na for hotel nai I dey sleep, and I no even get official car and I no dey see correct material wey go helep us train. “Nor be today nai me and my messenja, Daniel Amokachi go open our wallet enta market buy plenty things wey go helep us do training, and dis kain pipo go dey talk say na everything nai dem don give me to work. “D time wey I dey work for Mali, na d same week wey I chop knuckle with dem nai dem carry my car and house give me, and dat na country wey nor get money reach Naija. “Imagine wey d NFF pipo nor gree pay my assistant, Valey Houndionu. Na from my salary nai I dey pay d man, naso e suppose be? And later dem go dey yarn all of unu say na all d beta wey go helep me nai dem dey do. I don taya for all dis yawa,” na wetin Keshi talk be dat,”. Meanwhile, Oga Keshi don waka go meet hin wife and pikin dem, and we for Sapele Tafia Sports Trek go still follow am talk on d mata wey dey ground so. * Oya make we rub mind on top Sport mata. Btw Sunday Olise and Amodu Shaibu or Coach Ovis, who unu want make he take ova from Stephen Keshi? NA AUTHENTIC FILA MORIS DESIGN WEY DEY OKPE RD NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK.
Posted on: Fri, 04 Jul 2014 10:25:41 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015