Sapele Glory Must Be Restored: DORO Answer to yesterdays - TopicsExpress



          

Sapele Glory Must Be Restored: DORO Answer to yesterdays Questions! 1. Una get the answer but una nor state the benefit, the answer na Okotie-Ebor Statue and the statue nor de of any benefit to us. 2. Ibori nai be the best governor wen Delta State don produce since 1991. The reasons be say; Na during him tenure nai we take get Teaching Hospital, during e tenure nai dem take start the reconstruction of both our market and stadium, during him tenure de nor de owe teachers and civil servant salary enter the second week of the next month, during e tenure nai some of our tertiary institution take emerge. 3. Adam and Eve fork up nor be disobedience, na because non of dem gree admit their disobedience. 4. The name of the oldest man for bible na Methuselah and him live for 969 years am not sure sha.. 5. The tribe wen like fight pass for Delta State here na Ijaw people, wen dem here sound of war dem de happy like small pikin wen wan sip from e mama breast. 6. Na Okpe people drag land pass, I remember one late Chief Daddi wen get compound for Anegbe Lane, that man de drag land like 7 days rain, but Itsekiri people na full community dem de drag, I fear Una. 7. O boy for this Number 7 question I nor know wetin I go answer but make I try; na Urhobo de top de list of who marry pass before during the era of traditional farming, because according to dem, de say the number of wife and children wen you acquire, the more harvest you go get, in regards of farm work, dem also say na the number of wife and children wen you get nai de qualify you to get chieftaincy title. Itsekiri and Ijaw men just de marry any how de born any how, because dem say na dem be minority for Delta State, so the both tribe de do competition to increase their communal population, but Itsekiri men eyes nor good for woman before shaaa o. 8. The meaning of Ogorode for Urhobo na big bottle. The effect wen dis big bottle don get for this place be say almost all the company wen de this particular area for the town don die finish because dis big bottle de swallow dem. E.g Delta Pack, Top feeds, even flour mill de go down by the day, na only the management of Top feeds nai quick sugy nai make dem pack go west. 9. My Full name na Comrade B.J Wisdom. Make una go find out wetin J and B mean, I de fear una, make una nor go show Frank Omare and Bem Igbakpa where my secretariat de, because dem nor go think twice before dem gradam. 10. I go vote Ibori enter over and over again. Even with money wen him gbanscale people still feel the impact. 11. Na Demolition Bob, wetin be free antenetal, you don born once, every body benefit from the demolition. The winner of the question na my Oga Sapele Tafia, because him text me all the answers, LOL. Na me win o. Sapele Glory Must Be Restored.
Posted on: Fri, 27 Jun 2014 08:11:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015