Sapele Glory Must Be Restored! INCREDIBLY UNBELIEVABLE Today - TopicsExpress



          

Sapele Glory Must Be Restored! INCREDIBLY UNBELIEVABLE Today na I witness wetin big pass my head as dem catch one small girl with uniform about ten years old wen enter one church for New Ogorode Road wen dem de call Victory Family Assembly(A.K.A VIFA) this pikin bold enter enter inside the chirch open offering bus begin pack offering, the God wen won punish her make her nor fit notice the presence of people, na so the Secretary of the church, mrs Okotie and one other lady just gbab her, up till now the piken refuse to disclose her identity because the women say dem wan just tell her parents wetin thier pikin do nor be say dem need any thing from dem. To me I believe say that pikin na one of all those evil prophet wrn de the town nai send her, I know say una go de reason within una say why Olofofo de yan like dis, off cause na fine question and I go answer una, I small wen den start to build Ebenezer Baptist Church for Okpe Road, dem go biuld reach some extent dem go scatter and start again imagine the millions wen dem waist for that place, but by the grace of God dem manage completam 2 years ago, the project almost senior my mama. Another church wen de go through similar crises up till now na that Anglican Church wen de Boyo Road nor be small money don enter that place, the roof dem don removam two times and una know say those roofs na millions dem de cause, all this things nor be ordinary hand evil people de carry thier offering de fo evil alters to see say the work nor grow but thank God say baba God disgrace this one.
Posted on: Thu, 30 Jan 2014 16:48:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015