Supa Eagus coachi, Stephen Keshi don yarn say Naija and Stoke City - TopicsExpress



          

Supa Eagus coachi, Stephen Keshi don yarn say Naija and Stoke City strika, Peter Osaze Odemwingie don knee down beg am afta de guy been yab Keshi lass year sake of sake de coachi no carry am go de 2013 nations cup. Na for Twitter na hin Odemwingie take yab Oga Keshi dat time afta dem tell am say hin name no dey de final list of playas wey go follow Naija enta South Africa. Oga Keshi tok say im and and Odemwingie don dey tok tey tey and wahala no dey between de two of dem sham sham. “Walahi, me and Odemwingie dey tok well well afta pipu been dey carry am say wahala dey shelle between de two of us. Naso dem tok too for Yobo matta. “Na amebo pipu dey dey shout say I get kwata with Osaze and Yobo, and na lie becos me and de two of dem no dey fight at all,” naso Oga Keshi tok Na February 29 2012 de time wey de Naija Supa Eagus jam Rwanda for Nations cup kwalifia na hin Osaze don tap ball lass for de Supa Eagus, but Oga Keshi tok say de guy don beg am. “Odemwingie don knee down beg me and all Naija fans wey para for de kain yeye tori wey hin take yab me for twitter dat time, and I don forgive am,” Oga Keshi add join Osaze tap hin fess game for de Naija Supa Eagus for de year 2002, and na 9 gols hin score for inside 55 games.
Posted on: Thu, 27 Mar 2014 08:18:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015