THURSDAY 23RD AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

THURSDAY 23RD AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOO........... Report reach us say regular students date of resumption still dey complicated as some dey say 9th of nov while others dey say 9th dec, wen we try reach management for detail e prove abortive as dem no dey on sit.................. Report take leg waka enter our studio say after the mush disturbance from students auchipoly don finally start to sell change of course form and na 1,200 dem dey sell am for unity bank for auchi here, and make una take note say school of business don full as no body go fit change go there bcos na only public admin dey collect change of course form for school of business before but now e don full since so no just waste ur money oooooo................ Report reach us say school management don finally upload dey ND admission list for first and 2nd batch on net and dis na d site wen u go take check am auchipoly-online ................ Report reach us say the ND 3rd batch admission list go still dey on hold due to say d people wen wan post am travel go dubia for program so make una take note............... We still receive report say latest monday dem go don upload the just concluded HND CBT result for auchipoly site so make una take note................. We say congratulation to those spat ND2 and ND1 wen don finish exam and we wish una happy holiday with merry christmas and happy new year in advance...................... Report reach us say na today we go know the actual department wen dem carry go campus 3 and we go tell una for our friday news.................. Report reach us say accident happen for campus 2 road as na 2 bike nai collide and dem break d student leg wen dey inside but thank God say e no pass so oooooo................. We dey receive report from different departments say final year students dey complain say dem never see their graduation markers and their final exam don almost reach, hmmm if any students no see dress wear na wahala ooooo.............. If u get any problem regarding Admission issue whether na ND or HND or u get any school problem wen u no go fit solve and dat u need advice or help make u call us or text us d problem as we go help to ratify am, if na within our power dis na our number 08187759187 and he go dey on from 8am to 8pm oooo, abeg make una no flash oooo.............. NOTICE On Wednesday last week nai sombody block us for facebook as we lost all our friends of over 5000+ as we dey talk so we don even import expert to help us recover dat account, so make una no vex as we say we no fit dey wait for dem until dem reopen dat account................ Bcos una go begin wonder were we go and una no go fit dey get news again nai we come open dis one, abeg make una no vex bcos our expert wen dem dey work on am don tell us say na 50 50 dat say e fit work e fit no work.............. So make una begin add us or send us friend request again oooo so dat una no go miss our news and una go still dey close to us incase una wan tell us any information or problem............. Ones again make una no vex for any inconvenience e go cost una, bcos we know say we no strong but na GOD strong pass............ To send us friend request just enter Add friend and we go accept u and pls incase we no quick accept ur request make u no vex, bcos na only 100 request we fit accept for one day ooooo una thank u............. Abeg if u don add us before and we never accept ur request just add us again as we go accept am now, una thank u.................. Na here we go take end our news today incase u get any news or info or advert make u inbox us as we go post am for u here live. Make una no miss our tomorrow weekend news oooooo................. AUCHIPOLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D EAGLES EYES OF AUCHIPOLY Nai dey give una dis ogboge news, abeg make I go baff ready to travel una bye bye..............
Posted on: Thu, 23 Oct 2014 06:06:01 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015