Tit bits from akwa ibom aka d land of promise, aka d land of - TopicsExpress



          

Tit bits from akwa ibom aka d land of promise, aka d land of fulfillment, aka d land of uncommon transformation, aka d land filled with beauties aka... phew! D aka dem plenty. Abeg lets get down to biz. Its nt an easy tin in camp dis first wk in awka ibom as d igbo gals and guys na si ke efe ne mei gi, ehia! and nna men! Mu-wa e wa ta ra dis ppl self. In der igbo intonation. For e no belike say i dey akwa ibom but one eastern state for dem plenty & dey no want make we hear word. Na so one enter mami go chop and after he finish guess wat he said to akwa ibom woman wey pidgin dey hard Biko ye mu handkerchief, kam fi chie a kam men! I burst laugh and wen d guy know y i dey laugh he laugh himself. Abeg is igbo our first lang? The UI graduates jst want to show off hw brilliant dey are. (we no come read book for camp). As early as 5:30am we dey camp ground, but to my suprise once it gets to 7am na der i c say wen guys dey struggle to prep come parade ground d gals get time to paint face and lips(i mean beta artistic drawing of d eye shadow & pancake even blush). I now know d oda color i do c once on parade ground RED lips apart from d white dat everyone wears. Dis brings one question to mind na who dem dey paint 4 for dat darkness? For after morning drillin der face is nth to behold. One of d most suprising tin in camp is d foreign students (as dem tell us) 4 if u put dem with akpos even akpos go argue say dem no foreign 4 der gragra pass anytin, pidgin na der akpos go pass dem wit small margin (me dey ask wer dem do foreign, for dey worry pass indigenes) As for d camp itself its been good, training hard & tiring, legs aching, bed sweet to lie bt nite too short & sleep hard to come by. well dis is d much i have for u for dis wk, stay tuned, stay connected to dis page same time next wk, same me for anoda round. #NYSCbatchB2014
Posted on: Sat, 09 Aug 2014 22:37:29 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015