*U used BlackBerry to oppress, now almost everybody has a Black - TopicsExpress



          

*U used BlackBerry to oppress, now almost everybody has a Black Berry. *You used ur camry, end of discussion or "evil spirit"to Buga, now boys dey use am dey do taxi. *Before u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka, *B4 u dey use ur ipad dey swag...now ipad na heavy load to carry comot for house. *B4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary skul student don dey wear am troway, *B4 u dey go vacation 4d UK dey talk pass urself, boys don dey buy 1st class ticket dey enta london just to go lick ice cream.. BOTTOM LINE: no dey over do like say dat tin no go reach another person hand. All na vanity, e dey fade like Aba Jeans..no 4get say tortoise car na big man motor b4 o.. Notin wey come wey no get expiry date, even the life u have na borrow you borrow am.. Humility na the best choice!!
Posted on: Fri, 07 Jun 2013 16:49:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015