U used blackberry to oppress, now everybodi has a blackberry *u - TopicsExpress



          

U used blackberry to oppress, now everybodi has a blackberry *u used ur camry to buga, now boys use camry to do taxi *be4 u dey use ur plasma screen dey swell, now dem don dey use am watch ball for buka. *b4 u dey use ur ipad dey swagg, now ipad na heavy load to carry commot 4 house *b4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, now secondary skul student don dey wear am troway *b4 u dey go vacation 4 UK dey talk pass urself, now boys don dey buy 1st class ticket dey enta london juz to go lick ice -cream .....BOTTOM LINE..... No dey overdo like say dat tin no go reach anoda person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean. no 4get say tortoise-car na big man car b4 ooooooo. Notin wey come wey no get expiry date, even d life u have na borrow u borrow am.... Humility na d best choice.
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 13:38:01 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015