Una goodmornin o my people...first of all the. Children and family - TopicsExpress



          

Una goodmornin o my people...first of all the. Children and family of late mr orienta say make I thank una as una join hand together help dem do their papa burial last night..there say drink and money no go fit reach to pay una for d bring wey una bring una sef com outside for last night from una respective home com help do their papa burial.my ijaw brothers and sister we tank una for una cooperation and I tank una well well bcuz throughout d night nobody fight or quarrel for d burial ground..the onlytin wey happen for ground be say one of late mr orienta pikin com dey cry dey faint last night..d incident com draw many people attention accordin to d information we gather be say ever since wey there born this. Boy he neva use he two eyes see he papa once..b4 the pikin realise say he father still dey alive it was too late na the dead body of he father he com meet..meanwhile I wn still use this opportunity tell the musician wey com play for burial ground say u no try at all your name na teacher u suppose know the meanin of ur name..for that fat woman wey her name na mamaG yestaday na the first time I dey see u ever since I dey update about you I wn just tell you say you fall my hand as you go carry igbo root com the burial ground..abi u hear say dead bodi dey drink igbo root...this morning the corps of late mr orienta will be taken to his home town once more I tank una for una for una cooperation and understandin
Posted on: Fri, 25 Oct 2013 06:51:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015