WAEC examination. Akpos was asked to complete the following: 1) - TopicsExpress



          

WAEC examination. Akpos was asked to complete the following: 1) He who fights and runs away? Akpos: e don surrender be dat na, na fear catch am. 2) A rolling stone? Akpos: e no fit just dey roll, na person push am. 3) He who lives in a glass house? Akpos: Na rich politician e go be. 4) A stitch in time? Akpos: e dey prevent further tear tear na. 5) Birds of the same feather? Akpos: Na the same mama born them na. 6) One good turn? Akpos: Na correct power steering fit do am o. 7) A bird in hand? Akpos: Wetin e wan be again if no be barbeque. Dem plenty for chicken republic. 8) Half bread is better than? Akpos: Puff puff, buns or garri without sugar. 9) A journey of a thousand miles? Akpos: Na the person wahala be dat na! Why e no enter car or aeroplane jeje? 10) He who laughs last? Akpos: The person get brain problem be that o. Make dem examine am becos na the beggining of madness be dat. 11) A patient dog? Akpos: Na hunger go kill am one time. 12) All work and no play? Akpos: Na Only bank job fit be like dat o. 13) Once beaten? Akpos: Na revenge go follow b dat. 14) A fool at forty? Akpos: U never see Naija own, our own starts @ 50. 15) A friend in need? Akpos: Na parasite b dat. (16) Slow and steady... Akpos: Walahi na last u go carry.
Posted on: Fri, 07 Jun 2013 20:38:11 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015