WAHALA WEY PASS ASUU WAHALA Wit wetin we know b4 2013 we govt go - TopicsExpress



          

WAHALA WEY PASS ASUU WAHALA Wit wetin we know b4 2013 we govt go don yamutu N426.53bn kaluba on top we education 4 Naija, dis 1 dey among N955bn kaluba wey bi say dem don yamutu b4 on top Naija education between 2010 and 2012. Wen we dey yarn dis plenty kaluba wey bi say dem don yamutu we go see say plenty lie lie dey on top how much kaluba wey bi say we govt yarn say dem yamutu on top Naija education, abeg make we visit we Tertiary skool dem or make we try 2 yarn wit any of we skool pikin dem na him go make us know say plenty things dey happen 4 we skools na there we go come no say no bi only infrastructural renovation we skools dem need but we skools dem need gud educate wey oyibo dey call quality education. Wen dem dey rank d best tertiary skools dem 4 d whole world e dey pity say Naija skools dem no dey among d top 1,000 skool disgrace. Even 1 of we own pesin wey bi say him na professor wey him name bi Ukachukwu Awuzie and 1 former presido of ASUU yarn say in 2011 dat d best best university 4 Naija no dey among d first 6000 skools wey dey world anoder disgrace. If only say we govt go yarn d koko of d mata we go see say wahala wey dey face we education 4 Naija pass d 1 wey dey face ASUU strike. Make we reason am dis way say if dem call ASUU strike off 2day na wetin Naija under-graduates and post-graduates dem go dey do? ASUU dey yarn say make we govt add more kaluba 2 we education budget but nobodi dey yarn about d kaluba wey we govt don yamutu on we education b4 how dem take yamutu d kaluba? If we govt agree 2 add 2 Naija education kaluba say dat 1 go make we Naija education ranking go up 4 d world or e go improve d quality of Naija education? Na him bi say make we begin 2 hold we govt and we university governing council 2 give account.
Posted on: Thu, 19 Sep 2013 09:06:36 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015