Wahala dey o! My pikin come from school say make I go register am - TopicsExpress



          

Wahala dey o! My pikin come from school say make I go register am for Kids Got Talent Show I ask am say wetin be im talent e say dancing and singing, I say since when, e say since when I born am. How come I never hear am sing before e say na for bafroom e dey sing. Na me laf people pass wen dey come on live tv dey think say dem be Celine Dion so how I wan take remove hand from dis kain matter. The boy actually dey cocky say e go win. Wahala dey!
Posted on: Thu, 10 Jul 2014 19:36:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015