Wish 9ija could be Egypt where electorates would maintain their - TopicsExpress



          

Wish 9ija could be Egypt where electorates would maintain their ground. Where people will come together and say NO to nefarious leadership. No yawa now dem don give us too much 7up so the difference plenty no be small. Kai Gani Fawehinmi & Fela Anikulapo make una no sleep oooo. Anyway, one day na one day wey dem monkey go go market wey him no go sabi road go back sha. Imagine, Mandela no comot him country go treat same sickness wey him and Philip for England dey swallow. But ordinary local govt councillor for 9ija go run go Europe go treat cough wey paraga fit cure. U dey blame ham? Now bcos of dem too much patrol abi na wetin, the yeye UK don fly shoulder dey demand £3000 deposit to secure return. Na God go swallow dem. Person tell me sey make I no dey compare 9ija with UK. So my question be sey Why 9ija govt dey send officials go learn from UK when we get plenty professors for 9ija? Na when UK send him officials come learn from us abi we no get talent? Governors now no dey tender 9ija certificates now o na Camriver Uni, Uni Bombey, halfbad Uni, Toronto Uni, Chicago bulls etc u go dey hear. Na wa o so Uni Phort, Uni Lag, UI, OAU, Uni Ben etc don loose dem value be that? Hmmmmm Na God go judge sha. No be small thing ooooooo
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 01:35:17 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015