YULETIDE Chicken was looking at the calendar and suddenly - TopicsExpress



          

YULETIDE Chicken was looking at the calendar and suddenly shouted Chicken: Jeeeesuuus!!! Today na watchnite ooo. A day befor Christmas. Ha! ( In tears) I don die ooo. So na like dis I wan take die? So na me Mama Nkechi wan fry, take use Do stew? Ram was passing-by while singing shoki Ram: Padi mi ! How far na? Na tomorrow ooo Chicken: Come, dem send u? Abi na u b d witch wey follow me come from village? Ram: Hahahahaha, shey u don go for confession??? Chicken: God go punish u ooo. Ha! Chicken begins to cry Chicken: Oh God, why me? Why I no get ebola sef? Why e com b say na only monkey, bush meat and bat get am? Baba God I need ebola oo, if not na die I dey ooooo. Aaaaaaaaah!!! All dis chickens dis people want to kill, hmmmmmm. All dis blood dis humans are sharing, DIARIS GOD ooooooo Merry Christmas Friends
Posted on: Wed, 24 Dec 2014 20:58:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015