just got home now and met my neighbour(Emeka) crying like a - TopicsExpress



          

just got home now and met my neighbour(Emeka) crying like a baby,then we got talking. Me: Mekus wetin happen now...who die nau??? Emeka: Bros na Amaka o Me: chizoooooosu!!!amaka don die???? Emeka: my brother had it bn she even die sef I no go cry...dis girl has finished me ooo Me: oya pls calm down and tel me wat happened Emeka: Can u imagine Amaka dat av bn paying her school fees up2 her final year now use idiot 2 save my name in her phone.... Me: mshhhhhhhhhhh na d idiot dey pain u??? even makin u cry? U get time my broda... Emeka: Bros no be d idiot dey pain me,d tin is dat my own idiot is idiot number 18 Me: hmmm my broda manage d idiot nau,afterall my own girl dat I wan 2 marry use Evangelist David 2 save my name in her phone... Emeka: (laughing now) na waoo atleast dat one is even beta... Me: shut up! Wen I scrolled d phone further I saw 3 other evangelists(Ibe,Timothy and JacoB),then 2 pastors(Mike and Anthony),and den 4 Apostles (Chidi,Samuel,Mike,Greg),den 2 Rev(Chika and Ifeanyi)and then one bishop Francis.... Emeka: hahahahahahaha may be dat bishop is d general overseer of her heart and u be ordinary branch pastor!!!! Thanks Matthew 4 d joke, Really Funny!!! abeg ₪o laugh alone share with other people and enjoy urday. God go soon catch all this women and the pastors I tell u....... goodnight
Posted on: Tue, 27 Aug 2013 20:46:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015