ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 friday 10th october 2014. by - TopicsExpress



          

ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 friday 10th october 2014. by prof headlines: -di ambassador of america to wi contri don deny one kyn tory wey tok say e bi like say america govt dey behave like say de no won helep us to fight against di boko haram jaguda group -wi minister of state ontop heleth-mata don tok how many of wi naija-pipo fit collect one uturugbeke fever like dat -olopa-dem for tanzania don drag some pipo go court sake of say dem kill some pipo wey de tok say de get kpiankoko -di presido of fifa don tok say dem go soon cancel dat away goal rule -one of wi naija ogbonge bobo musician don release one of ein new song ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 friday 10th october 2014. by prof ‘’de say, no mata how friendship tight reach, wey go make you change your family-name, to your friend own-o’’ Di America ambassador to wi contri-naija, Mr. James Entwistle, don deny some kyn tory-dem, wey dey fly-fly up and down-now say, e bi like say, di govt of America dey behave like say, de no won support wi contri ontop wi fight against dis boko haram jaguda group for di north east part of wi contri. E say, nothing like dat, say, make wi no forget say, di war get plenty politik poto-poto for body, more-dan, religion-mata-dem. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na who dey do-well, de dey praise-o’’ One ogbonge international Africa business group, di Africa Investor (AI) don give award to wi contri oga-madam ontop money-mata, Dr. Ngozi Okonjo-Iweala, as di best minister ontop finance-mata for Africa dis year. De say, de give-am di award, sake of di correct work-dem, wey she don do ontop wi contri economic-mata, wey dey make am grow-now, dey gada plenty business-pipo-dem from akata, con do direct business-now, for inside wi contri-naija. Tory say, de hang di award ontop, madam Okonjo-Iweala, neck for di face of plenty crowd of pipo-dem, wey come chop, inside, Ritz Carlton hotel, as part of di event-dem wey dey shele, inside di IMF and World Bank every year meeting, wey dey go on-now, for Washington DC for America yonda. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’ na di way, wey fawo-mama take run ein pikin-dem, take dey know say, enemy dey around-o’’ Wi oga federal govt don shout come out con tok say, na about 29 million of wi naija pipo dey face di risk to get one wicked fever, wey de dey call, ‘Lassa fever’ and na 26 state-dem inside wi contri, dey expose to dis oturugbeke disease. Na di minister for state ontop heleth-mata, Dr. Khaliru Alhassan, offload dis warning today for Abuja, during di shion-shion zim-zim wey ein yan with wi newtory-pipo, as de dey mark di National Lassa fever day and dey receive some 5000 safeguard soap-dem, wey one group, wey de dey call, Procter and Gamble Nigeria present give di ministry for heleth-mata. According to oga Alhassan, e say, for only 2012 alone, wi contri record 1,944 case of Lassa fever, and out of dat number, na 207 pipo kpai, and e say, among dos wey die, na dos wey bi heleth woker-dem wey bin dey helep pipo wey dey sick di sickness, na-dem die-pass. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, dem say-dem-say, no dey get who say-o’’ Di oga ontop newtory-mata for Cameroon, Issa Bakary, say, na lie bi one kyn tory like dat, wey just dey fly up and down say, di boko haram jaguda group don just release some pipo wey dem kpakee for di northern part of Cameroon, e say nothing like dat. Oga Bakary, say, dis tory wey just come out ontop one website, shock-am well-well. According to di lie-lie tory, de say, di boko haram jaguda group don just release di wife of di deputy prime minister of Cameroon, Amadou Ali, 10 Chinese-pipo plus some district head-dem, wey dem kpakee for di difren-difren place-dem for di north of Cameroon. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na only animal wey get tail dey fit turn ein tail, and no bi tail dey turn animal-o’’ Di joinbodi of petroleum worker-dem inside wi contri, di Nigerian Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG), don yan today say, dem no get any plan to go strike sake of bad road-dem mata inside wi contri. Na di News Agency of Nigeria katapot one report say, di branch of di union for Abia plus Rivers state dey strike now, b’cos of bad road-dem wahala for wi contri, wey no dey allow dem dey do dia work for dos state-dem. But di nationl presido of NUPENG, Mr. Igwe Atuche, con yan today, say, di national body of di union no plan any thing like dat. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na wetin farmer, don put for inside ground, e dey count as wetin ein don plant-o’’ Tory say, di budget of Lagos state dis year, don perform reach 86 percent, as dem take calculate-am from January go reach September dis year. Na di oga kpata-kpata for Lagos state, Babatunde Raji Fashola, nak dis informate today for Alausa, Ikeja, by di time weyn ein dey yan shion-shion zim-zim with wi newtory-pipo-dem, after e take second eye look into di level wey dem don take di budget perform reach, for di first three quarter of di year. insert……..3rd qtr/ brf E say, dem handle plenty more ogbonge project-dem during dis period pass dis same period of last year. Oga Fashola say, di soap-dem wey de share give di govt school-dem for Lagos state, sake of di Ebola wahala, na di over 11,000 youth-dem wey dem train how to make soap, na dem supply-dem. insert….3rd qtr/brf 2 E say, di state govt don collect 84 percent of di money wey wi oga federal govt don send give-dem. Wi newtory-person, Immanuel Odeyemi, katapot report say, di oga for budget plus economic plan-plan-mata for Lagos state, Mr. Ben Akabueze, say, na road construction dem go focus all dia mind put-pass to do, during dis dry season, wey bi last quarter of di year. ----------------------------------------------------------------------------------------
Posted on: Fri, 10 Oct 2014 19:23:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015