1. Baba God na mai Shepherd, I dey kampKe 2. He make me sidown for - TopicsExpress



          

1. Baba God na mai Shepherd, I dey kampKe 2. He make me sidown for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi dey cool like Thermacool. 3. He panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness for sake of His Name. 4. I swe! If I waka pass where any evil, arm robber, 419, boko haram and juju people borku, I dey kakaraka noting go do mi, even if I waka tru d valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko? Na so them dey like back bone dey comfort me. 5.You don package food wey I go chop. All my enemies dey look anyaya. You rob me for head wit ur anointing . My cup na Ogunpa River wey come overflow hin bank. 6. True, true, betta life & mercy go gum my back till I quench. And man go tanda for God house sotey sotey from now and forever more
Posted on: Wed, 19 Jun 2013 16:25:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015