99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: After Governor Adams - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: After Governor Adams Oshiomhole of Edo State bin use vex take tell one widow make she go die, as im bin dey do inspection of Edo State waka ontop to take stop street trading & hawking naim the widow, Mrs. Joy Ifijeh bin dey beg am make im no pursue dem commot from where dem dey do street trading. We hear say Governor Adams bin come later invite the widow come Edo Government House wey im apologise give the woman ontop the “Go & Die” talk wey im bin tell her, im talk say nah anger bin make am do dat kain talk, sake of how people bin dey try frustrate im government effort for Edo State. But as e be now im don promise her automatic employment & im donate N2 million give the widow… Bigmo (@bigmoNaija) come dey ask how u see dis matter & weda nah blessing in disguise we go call dis matter? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #LoveAndResponsibleTuesday #GoAndDie #DisabilityDay Twitter: @WazobiaFMAbuja Tel: 094-600-995 wazobiafm/abuja995 punchng/news/oshiomhole-donates-n2m-to-widow/
Posted on: Tue, 03 Dec 2013 05:28:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015