ABEG ASUU NO CALL OFF STRIKE AGAIN OOO! I have my doubt if life - TopicsExpress



          

ABEG ASUU NO CALL OFF STRIKE AGAIN OOO! I have my doubt if life could be sweeter than this again ooo. Imagine, food on my table (thanks to my sisters) before I wake up (around 10am); I brush my teeth I no brush am, na make I tanda gidigba for table and eat. You call me dirty boy? Na U Sabi! No be brush daily oyinbo people sey, abi na brush before eating early in the morning??? Abeg Ooo! After eating, na my bed sure pass; facebooking, tweeting & chatting on point- 2go (boyinde1), whatsapp (080324342180), bbm (22dc20fb) e.t.c, in case we’re chatting and I don’t reply your chat again, I don sleep off be that…no vex jawe… proudly supported by ASUU noni. Abuse me…call me names- lazy boy n so on, I careless! Abeg make you hardworking students go learn “ise owo” ‘cos na “ise owo” sure pass for Naija now. Guys go learn Plumbing, there are few people in that line; imagine your gain as the only Plumber in your village. Ladies go learn trading and marry…or else if you dey wait for ASUU, you go all become ‘mama’ for Uni ooo. ASUU call off stike, dem no call off, I no go school again jor, na tew dey enjoy this life. U like tew join me also?
Posted on: Mon, 22 Jul 2013 14:35:41 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015