Away From The Bombings Make We Laugh Small Make Thinking No - TopicsExpress



          

Away From The Bombings Make We Laugh Small Make Thinking No Kill Us. ★ Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card. ★ Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship. ★ Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic. ★ Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria bcos their colour na Green. ★ Na only for Nigeria you go see fish inside MEATPIE ★ Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines. ★ Na only for Nigeria PHCN dey sey:-Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity) ★ Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green. ★Na only. for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin, Puff puff and beer. ★ Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world... Trust me. ★ Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering wey dey do him NYSC 4 Police station. ★ Na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent Internet? ★ Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer. ★ Na 4 only Naija, you go see Mad man dey control traffic, people wey their head correct dey obey... ★ Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself. ★ Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money. ★ Na 4 Naija obituary poster dem go say MAMA HAS RELOCATED. God blss my one nd only kontry. NAIJA GO BETTER, NAIJA FOR LIFE. One love. One nation. One Nigeria.
Posted on: Sun, 27 Jul 2014 16:51:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015