Chai! Hw tym flies! I jst dey rememba wen malle n palle dey hala, - TopicsExpress



          

Chai! Hw tym flies! I jst dey rememba wen malle n palle dey hala, sht n flog me bcos i dey shw d talent wey Baba God giv mi. I rememba wen in d mid nite i go wake up bgin dey write songs wey jst enta my head. Dat tym eehn, na difrnt difrnt sch i dey go entertain. Ppl wey dey do marriage, go ask mi 2 com sing 4 dem. I get 1 beret wey i carry attach hair sew inside. E go b lyk say i get dada! Malle go dey cry say she don born useless pikin! (may her gentle soul RIP). If 2 say she dey alife 2day 2 c me, i 4 happy wella. I no say plenti ppl pass thru am sef. Hahahahahaha! If u play ball dat tym, na cane u go chop 4 yansh, u dey sing, ah! U useless! U sabi talk n ppl dey laugh, u no serious, n na mumu u b! Bt, 2day nko? Football, Music, n Comedy don bcom money spinning machine! Parents nw dey encourage dem pikin dem. I THANK GOD 4 MY TALENT! Baba! Receive all d Glory! What abt U???
Posted on: Thu, 31 Oct 2013 21:17:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015