Conversation between a hungry Rat and House Owner Rat:.... (with - TopicsExpress



          

Conversation between a hungry Rat and House Owner Rat:.... (with tiny voice) hello. Man:.... hello, who am i speaking wit? Rat:.... na Mr Steve be dis abi? Man:.... yes u are speaking wit Mr Steve..., who is dis pls? Rat:.... so u no recognize my voice abi?....Na me ur room mate. Man:.... u say what?. Rat:.... ur room mate Rat..., I dey ur room now.. Man:.... i beg ur pardon? Rat:.... which yeye beg u dey beg... i never chop since yesterday wey u waka comot... I check that place wey u dey put food.., i no si anything... I check d kitchen nothing. I even check ur fridge no single food there. E be like say u wan kill me wit hunger abi..No problem.., i just say make i let u know say that ur certificate 4 inside your wardrobe wey dem write LAGOS STATE UNIVERSITY..... i don eat d "LA" comot. e remain "GOS" STATE UNIVERSITY...,L et me see which work u go take "GOS" state university find..,yeye man........#
Posted on: Wed, 07 Aug 2013 22:17:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015