E get one particular restaurant wey i dey chop 4 wuse - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey i dey chop 4 wuse zone2 Abuja, E get one oyibo man wey dey always come chop there too... Any tym dis oyibo man chop finish he go shout Hey, so I wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin d oyibo man dey always chop so maybe me self go shout too.. when i reach d restaurant last wk friday, i order wetin d man dey chop.. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but i no shout, i colet xtra plate, but i stil no shout.. na then i just vex ask 4 my bill. D waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d xtra plate na another N75,000 TOTAL:N150,000.... na then i shout heyyyyyy heyyyy heyyyy heyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy, still shouting till now............ If na u waitin u go do?
Posted on: Thu, 17 Jul 2014 14:00:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015