Jon the Baptist Tok Again about Jisos 22After dis, Jisos and in - TopicsExpress



          

Jon the Baptist Tok Again about Jisos 22After dis, Jisos and in discipols com go di area of Judea and dem kon stay der for some taim dey baptize pipol. 23Jon (di Baptist) dey baptize also for di town of Aenon, wey near Salim, bicos plenti wota dey der and pipol dey kon mit am der make e for baptize dem 24(By dis taim, Jon neva go for prisin). 25Den katakata kon bust between som Jon discipols and some Jus about how dem suppose to wash dia bodi clean as dia tradishon tok. 26Some of dem kon go mit Jon kon tel am, sey, “Oga, di persin wey dey wit yu for di oda side of River Jordan, wey yu bear witness about, si oo, di man dey baptize pipol too and everi bodi dey rush go mit am ooo. 27Jon kon ansa dem, “No persin go fit riciv anytin unless na from heaven God giv am. 28Una sef go fit bear mi witness sey, I say “I nor bi di Christ” but God send mi com bifor E go com. 29Di persin weywan marry new wife na im bi di bridegroom. Di bridegroom friend, (wey bi di bestman), wey dey stand near am and dey listin to am. E dey glad well well wen e hear di bridegroom vois. Na dis dey make mi hapi and my joy don full bam bam. 30E must dey popula mi, so dat pipol go sabi Am well well pass mi. 31Di persin wey com from heaven betta pass everibodi. Di persin wey dey dis world dey tok about di tins wey dey for dis world. Di persin wey com from heaven beta pass everi peron wey dey dis world. 32Dat persin dey tok about wetin e si and hear from heaven, but pipol nor gri lisin to Am. 33Di persin wey gri sey wetin dem to about God na tru, dey also confirm sey God really tok tru. 34Di persin wey God send dey tok God word, bicos God nor dey mak economi for di way E dey giv En Spirit to pipol. 35Bicos God lorv En pikin well well, E don giv am power to control everitin. 36Any persin wey biliv in di only pikin wey God get, go get evalasting life. But any persin wey nor gri to accept di only Pikin wey God get, nor go si life. God go dey vex wit dat kind of persin all di taim.
Posted on: Sun, 07 Jul 2013 08:50:59 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015