Make e no be like say na only me dey craze this evening cos of - TopicsExpress



          

Make e no be like say na only me dey craze this evening cos of laff! Make I follow spoil this evening for you! Oya na!........... •U collect babe number you use "chick" store am.....shey e mama na fowl?:> •Something lost, dey see am for your pocket, u cum dey claim say you no know how it get dia. My bros ur pocket na magnetor? •You wan toast ur pastor pikin you dey speak in tongue, she be demon? •U buy suya ur woman con chop all the meat finish u con dey smile dey chop the onion.....u be vegetarian? •u dey wit ur guy n u dey reciv diff kinds of phone cals in 5min, yet u dey claim say u no dey cheat on ur guy. My sista, u be mtn customer care agent? •U ask a girl for what she wants, she tells you money and you are angry . Were you expecting her to say wisdom and understanding? •u wear blue skirt,green trousers,yellowcap. You carry red bag,white speck,..u b rainbow?:x •Ur mates pay complete fare, sit down comfortably 4 bus, u pay half dey stand n smile. Bros u b usher? •Since last 2 weeks, PHCN never remember ur street n una no get common Tiger gen, yet u come my house still dey borrow Jackie Chan film from me...bros na PHCN office u wan go watch am? •Ur babe get 0.9 GPA for school, she still dey ask for Brazilian Hair of #150.000 . Where she •wan fix am?, Shey na on top that coconut head? •At d age of 45 u dey say i dnt av tym 4 boys nw i av 2 plan 4 my future,which future? shey! d 1 wey don pas abi d 1 wey dey com •U b 35 yrs old first class graduate u no gt job, U folo lil wayne dey sing *I aint gat no worries*...bros ur life dey 4 SoS. •U ask me 4 my number,,, I tell u 0706, u still dey ask me wether na MTN. No na ATM •U carry ur hand go steal person tin, dem catch u say na d work of d devil. U b satan employee?... •U buy Mr biggs chicken for her,come dey chop kpomo from agbo woman, bros u dey fear bird flu? •dem say u fail english, u say dat is umpossible. U wan form ur dictionary? •You give 3 ladies bele within two months! Guy, u b 2face??? Comment ur own
Posted on: Sat, 21 Sep 2013 12:06:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015