My Person, How everything now? I hear say u dey murmur, you dey - TopicsExpress



          

My Person, How everything now? I hear say u dey murmur, you dey complain & you dey grumble say you neva hammer! U no thank God ehn! U think say to see October 2013 na moimoi? Boko Haram reach ur side? U folo 4 Dana Crash? Aluu community pple catch u? U kno how many pple wey die for 2012 not 2 talk of frm Jan till now? Ansa me naaa, am waitin o! God wey give u good health no kno wetin e dey do? Naija no good, Naija no good: u dey use phone; blackberry, ipad, Iphone, Galaxy tab, Android & evn laptop, If at all u neva get money buy ur dream car or build ur dream house, shebi na persn like u dey trek about or sleep unda bridge? Abi u don see where person wey dey coma for sick bed dey chat? Abi na blind man wan change DP? or comment for facebook status? U still dey ther dey complain? Abi u don see where dead body dey read facebook & ping or whatsapp inside coffin? You better start thanking God now...
Posted on: Thu, 03 Oct 2013 08:37:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015