NIGERIA PIDGIN PROVERBS ***Craze no hard to form, na the trekking - TopicsExpress



          

NIGERIA PIDGIN PROVERBS ***Craze no hard to form, na the trekking be wahala. ¤¤ English translation: Easier said than done. ***No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. ¤¤ English translation: Calm down, your temper won’t solve the problem ***Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup. ¤¤ English translation: You can’t run away from your destiny ***Today’s newspaper na tomorrow Suya wrapper. ¤¤ English translation: Keep calm! Nothing lasts forever ***Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef. ¤¤ English translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush! ***Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different. ¤¤ English translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish. ***Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus. ¤¤ English translation: Give everyone what they deserve.. ***The difference between kpekere and plantain chips na packaging. ¤¤ English translation: Don’t judge based on appearance alone. ***Escort me, Escort me, na im slave trade take start. ¤¤ English translation: Serious things sometimes start like a joke ***The water wey dem use take make eba can never be recovered back. ¤¤ English translation: Don’t cry over spilled milk. Good morning how was ur night
Posted on: Tue, 27 Jan 2015 09:28:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015