NOON NEWS/UPDATES. We wish to inform Sapele Pipo both home - TopicsExpress



          

NOON NEWS/UPDATES. We wish to inform Sapele Pipo both home and abroad say, dat tree wen dey ripe every xmas period, wen we dey call CHRISTMAS CAROL , don dey ripe accross all d forest wen dey Sapele. Dis tree nai dey inform Sapele Kids about xmas, as dem don dey carry xmas signing from gate to gate make pipo for dey sign xmas gift for dem. From our studio here we dey helep Stanley Maka fine Children dey beg Stanley Maka say mak e pack go e Houx back, as e run leave e Houx for almost 2 weeks now wen e area nor get light. Na so heat rashes full Vannesa body and Mrs Bimpe Stanley Maka just dey cry, as all deir food wen dey Freezers don spoil finish and d poor woman don sell all her Brazilian Weavon take buy fuel finish. Stanley go face d wahala wen pipo dey face since, wen u dey soso dey advice. Nor insult, Nor insult. You must stay d darkness till d tori go end. From our Studio we dey announce Vacancy for A Qualified Nurse from School of Nursing with atleast a working experience. (Nor be who do Auxillary Nurse Oh) for immediate employment for ASCA Ogorode. Salary is very fatiologic. Apply now thru Inbox, as dis slot cum meet us dis morning from a good samaritan wen dey enjoy dis page die. Ufuoma Ogodo wen be the Zone 4 Commander of Vigilanty, done dey mak problem wit the Unit 13 Vigilantee for Gana mix wen him swear in just becos of say e wan use d power of e office tak collect part of Gana mix join d Rex Hotel Unit wen him for be Ex Unit Head b4 dem mak am commander. Ufuoma Ogodo na small Offix dem giv u now wen u one ova excercise ur power put. U nor see ursef. Randy call Ufuoma to order mak e nor start wahala wen e nor go fit end. D accident wey happen for Amukpe Roundabout dat on Friday, wey one trailer wen carry big, big gallons of Palm Oil cover-side (Capsize), those Army sell ojofri oil to pipo plenty before d owners cum. Dat na pure wickedness. *SAPELE WOMANIZERS SEASON 6. Mr Boyitie wey be Ejiro papa and dem dey stay opposite Orion Hotels and Fountain Hotel still dey beside their houx too. Dis man na shameless womanizer. All he children friends wen be girls nor dey like go their place again becos of d way dis Mr Boyitie dey manor and spin spin her daughters friends. One girl wen dem dey call Esilokun wey dey folo all those boys dey sing for Live Band for T.M, dey stay wit Mr. Boyitie family based on same member of Ultimate Power Church and her parents nor dey dis town,dis yeye Deacon Boyitie begin hide dey Po- line Esilokun until one fateful day wey Mama Ejiro catch dem two pants down stark naked nai she throway her out One construction work dey go on now for Abeke Primary School. Na so Oghenewaire Esusu just dey supervise d building work and e and one oda guy wen get big belle just buy beer dey drink under dis hot sun for front of Abeke Primary School. Na so e dey shout one guy name BAWO, BAWO, BAWO lolx. Ghost Mode. MAKE I GO MAMA AYOMIKE, MADAM 2 OCLOCK STORE WEN DEY BENIN ROAD, MAKE I GO BUY RICE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 20 Nov 2013 14:39:49 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015