News/Updates @ The Hour 26/05/2014 Today report - TopicsExpress



          

News/Updates @ The Hour 26/05/2014 Today report enter studio say some useless Mopol and Soldier wey dey front of ECoBank Sapele dey intimidate pipo wey dey pass the Bank front. Na dis morning nai our studio comfirm say dem dey sakpa one small guy wey wear pinging pens due to say the smallie dey make call wen e take come down from cab. We dey call on the management of d bank to stop dis officers from dis act or else we go petition the company becos unu dey against Human Right and Community peace of Sapele. Report reach us dis morning say Sapele entrance Okoloko Bridge don dey witness serious vibration against the heavy slab wey Hon. Henry Ofa use take barricade the bridge and d fence nor come dey allow sand dey pass through again. The bridge don dey experience heavy weight from both the rubbish slab and hip of sands wey dem abadone ontop the bridge. Hon. Julius Egbedi that bridge dem nor dey sweep am? I dey come for you. Report enter studio say those boys wey dey lock tyre follow Sapele do better work dis morning for Hausa Rd by Market as dem helep deal wit road defaulters wey dey park for road dey block traffic. Dem lock one Jettta wey just park block Hausa Road by Palm Avenue. Make unu dey work well for dat market area so dat the road go get better space. Report dive enter studio say people wey dey sell Goat for Hausa Road. Say dem wey go market go buy Goat come for us for consumption say dem get accident for Auchi road and two of dem die flat for d venue why d others sustain serious injuries,why the driver just get minor injuries. Make deir soul rest wit God nai be our prayer dis afternoon. Who Asikolo think say e dey decieve? E say e nor b cultist again and e say e nor won work wit anybody wen stil dey practice cultizm but Solo Biggy thief laptop 4 sapele b4 e run go Ghana Asikolo cover am bcos say Solo give am e own share and also na d same cult Eiye na him d two of dem dey. Solo Biggy go Ghana e thief another laptop 4 dat side. Now e don run com back 2 Sapele becos say pipo wey e chase from Sapele chase am too from Accra and wen e dey Ghana na So, so Eiye picture nai him dey post 4 him wall and dat one show say Solo stil dey do cultist matter and Victor Asikolo nor go tell me say he nor see all d cultist things wen Solo dey paste 4 him wall. Now Solo don com back, Victor Asikolo don put am join himself dey carry gun 4am dey hang 4 neck. Asikolo u nor go fit decieve us for Sapele and u b big cultist wen won use only ur Eiye people take dey incharge of Sapele but e nor go work as u dey always dey see other people as cultist but u nor dey see urself as d biggest fool of Sapele Vigilantee. If u nor change I go tell d world how u take dey do medicine make Mary and Ejele 4 dey like u so dat dem go 4get d Hilux 4 u bcos u dey brag 4 d town now say Omolubi nor get use 4 where u dey again say nor b ur Oga again but u 4 get say na him give u power. I dey com 4 u. I sidon 4 Mayuku Rd wen dey Koko wen I hear say EPZ wey Government bring come develop koko, Gov. UDUAGHAN and e Co-Associate move d project go OGIDIGBEN (Escravos) bcos say Koko nor get good, rich and influential leader wey go fit pump MONEY for e Senate Election. Too bad, I beg make IWERE NATION ask Gov. UDUAGHAN watin ITSEKIRIs benefit for e 2 tenure as Governor of DELTA STATE? Private and Goferment Schools across Sapele go experience public holidays for the National Childrens Day 2mrw. Our studio go celebrate Sapele Children 2mrw. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 26 May 2014 13:20:31 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015