SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 03/09/2014. WHO BE SAPELE - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 03/09/2014. WHO BE SAPELE LEADER? I don sidon look Sapele from near,i don waka go far to look Sapele,i don even sidon inside Sapele name,make i for fit comprehend Sapele very well but the more i dey ask my self say who be Sapele leader,na dat time i dey find am difficult to understand Sapele more. Now make i go straight to the point make i nor beat round the peg hole for nothing. Hope say we remember say i don sensitize unu before say old NEPA throway one particular line follow the town wey feed AT&P light? And dis line dem dey call am LINE33. The last tym i check this very line,i cum find out say nai dey feed the whole of Sapele light and the line hardly develop fault. The reason wey make old NEPA give AT&P dis line na becos say,dem be major Company wey need constant light to helep the people around due to deir production pattern. Sapele na one privilege town wey dey surrounded by water and oyibo dey call such place IRELAND. I dey very impress about this natural gift of water wey Baba God use take bless us,becos if to say people from this town fit sell River,nai be say River Ethiope for don go by now. Na from dis River dem dey use take dey generate light from Sapele,yet Sapele nor dey fit dey benefit from am directly due to previous and current bad leaders. I dey very happy to meet one old Engineer (Name Witheld) wey make me understand the difference from Line33 and our consumer line. Line33 nai be the line wey come directly from the major Feeders before them step am down to consumer level. This Line33 dey very special,and it hardly develop fault due to say the line na direct and if this line ever develop fault nai be say d entire Sapele nor go get light. Some places for this Sapele don dey suffer light for several months now and i dey very sure say dis new company BEDC na d first Electrical Production Company to manage Electricity for Sapele, Delta State,Edo State and Ondo State. This company assure the entire populace of good light and with the way and manner dey go now,many areas like IGBAYO, AT&P Quarters,ADENIYI ROAD some parts of Oguanja and environs dey suffer light badly,due to failed Poles and Transformers. But BEDC choose to pay less attention to dis issues and yet dem dey collect high fees from consumers as Bills. For House children dey happy when deir parents dey grow richer. We dey very proud of our natural resources and we dey happy say many of sons and daughters dey do very well and we expect dem to use deir various offices to bring positive change to the community but as i dey talk so na different thing nai i dey witness. Almost all the major and big Hotels for Sapele including all the Politicians Mansions don tap light from dis line33 to deir Investments and residential buildings. I try to look into this Line33 the best advice wey i get be say,if all the Hotels including all the Masions tap light from LINE33 e dey very possible say that line fit crash,due to say most of the Hotels go begin abuse the light and the load go cum dey too high for the major feeder. When House dey roudy,the House dey always dey lack cordination. My people i dey vex but i nor fit shout. Dis na d Hotels wey don connect from LINE33; ORION HOTEL 1&2. PEEMOS HOTEL. HAMSHIRE HOTEL AND SUITE. JOMAPH HOTEL. MOVIG HOTEL. D-STONE HOTEL. etc Sapele as a community don dey experience rationing of light for a very long time now,with d initial pattern of 4Hours on and 4Hours off. The areas wey dis rationing dey affect nai be d masses,becos most of all the big men for Sapele residential buildings dey benefit light directly from dis said line33 and from all indications,dat line hardly go off,except na general problem nai affect the town,nai dat line take dey go off. The people wey dey pay Bill wey dem nor consume,nor go fit just begin attack BEDC without the help of the Community leaders,but becos dem dey benefit light from Line33,dem nor fit understand wetin the poor masses dey pass through to enable them intervene. Now one Engr Gbenga wey dey responsible to pay the workers and company wey cum work on our failed Feeder,refused to pay the Engineers wey come work on the feeder becos dem don already finish their work and with dis feeder,Rationing go stop for Sapele and we all go begin enjoy our 24Hours Light without Rationing. Now who be the leader or leaders wey suppose helep us call dis BEDC or Engr Gbenga to order so that the poor masses go begin enjoy deir dividends of the natural resources wey God give us. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. WHO BE SAPELE LEADER WEY WE GO CRY TO? WHO AMONG THE POLITICAL LEADERS FOR SAPELE REALLY DEY FEEL OUR PAINS? WHO WE GO BLAME FOR THIS ACT OF NEGLECT? IF LINE33 GO OFF DUE TO OVERLOAD WHO GO SUFFER AM PASS? etc God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 03 Sep 2014 06:25:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015