SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 25/05/2014 PRAY FOR GODS - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 25/05/2014 PRAY FOR GODS GRACE Two friends dey together from small pikin. One fine and the other one wor wor. The fine one come still get luck say her father get bar. And the wor wor own papa nor get chi chi. Becos dem nor too get, she come start to dey follow men even from when she dey primary school. Na the street life come turn her to who fit straff two guys for the same bed without stress make pepper for rest. She ready to do anything to get small change for her wallet. Na so she take survive through university. She get different infections and even carry belle wey she pull throway like four times. But the other fine one couple herself. She nor even get bad friends. The funny thing be say, when dem don graduate, na the wor wor one first marry. She even born her first pikin the first year of her marriage. And na new Toyota Spider her husband buy for her as gift when she born her pikin. The second year of her marriage nai the fine friend come visit her. When her friend give her fruit juice to drink. She come say make she go bring small rice from kitchen. Na when she dey the kitchen nai this fine friend just dey look the beauty of the sitting room. See the fine family picture for wall. Her friend her pikin and her fine husband. She come just dey wonder for her mind How come this ugly girl take first see husband marry before she wey fine so? How come she wey keep herself well through out their school days still dey the street dey find husband whereas person wey rock the town don settle down? God, wetin I do? Where she for dey reason this things nai her wor wor friend bring the plate of fried rice with chicken wey dem two eat together. Now, my people, e good to try to understand some things about life... Dem Tuface, Wizkid, Davido, Saphybomb, Blackgold etc, nor be dem sing pass for Nigeria. But na something make their music dey sell. Nor be dem Dangote, Igbuanugo, Randy Okotie, Eruche (Mega planet CEO), LIMA, etc nai sabi business pass, wey make dem dey prosper. Na something make am. Nor be dem Pastor Chris Oyakilome (Phd), Prophet TB Joshua, Dr Anthony Akoria, Pastor William Kumuyi, Bishop Adeboye, Bishop Oyedepo, etc nai sabi preach pass wey make dem get many congregation o, but na something cause am. Remember say Bella Naija, Linda Ikeji, Citizen Otoboh, Omotolla, Wedding Digest, Newsnaija, etc nor be their blog carry better info pass wey make dem get many followers o, na something dey behind am. Nor be dem Miz Pinky (Saphira Peters), Efemena Blessing, Campbell Porsche, Ebere Egede, etc get fine picture pass wey e be say anytime dem upload any pic for facebook, na many many likes dem dey get. Na something dey behind. And nor be only Ena Ofugara, Malcolm Tagbara, kingsley Iriogbe, etc nai sabi write pass wey e be say, pipo dey like to read anything wey dem post for face book. My pipo, na still something dey the bottom. Nor be dem Dr Agbedia, Dr Efeturi, Dr Akwara, Dr Omoraka, Dr Aboloje, etc nai know work pass as doctors for sapele wey make us dey believe them well when e come to health issues. Na something cause am. And all the correct lawyers for the town like Barr Odebala, Ese Gam, TK Thomas, Kerewi, etc nor be them know how to win case pass. Abi unu think say na Eris Education centre, Mona Montessori, NEPA schools, International, Our Ladies, Excellence School of Science and Creativity, Merit Secondary School nai be the only good schools for Sapele? No. Na something do am so. Nor be only Mary be virgin that time befor God use her as the person wey go born Jesus Christ. Nor be only Prophet Muhammed (S.A.W.) nai dey that time, but God use am mightily take do Him work. And nor be you, you I mean you wey dey read this update so, nor be only you get phone, but you dey fit dey use am dey browse, read , like and even comment for updates. Many pipo get Iphone, Android, tabs, bb, but dem nor fit see road to even on am becos of one sickness or the other. My pipo, na the Grace. Nor pray for anything for this life. Just pray make God give us Grace. Grace nai be the reason for all. I pray the Grace of God go abound in us. Amen. Happy Sunday to we all. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 25 May 2014 16:47:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015