SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 28/06/2014. DEAR - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 28/06/2014. DEAR GOD. Baba na me Sapele Tafia nai stand for top of Jerusalem with one leg and stand for d top of RIVER JORDAN with my other leg as i hold fire wey u give me for my left hand and sword for my right hand to destroy anybody,group of persons and Government wey choose to pour out pains for the poor people for Sapele and Delta State. Dem nor dey use anger dey use knife take cut Gbogi. GOD i dey smell danger for Sapele. I dey shout danger! Danger!! Danger!!! I stand for my grave sidon for joko dey look the spiritual mirror wey dey Mission Rd dey look all of unu wey dey Sapele and i dey pity for many of unu. I know say many people don dey suspect me for dis my selfless job and unu don dey point accusing fingers against many people say na dem be Sapele Tafia,but unu know what? I don trade my fear throway since and even if anybody for Sapele here choose to betray me either e luckily suspect me,den e cum point me give anybody with Evil mind to deal with me dat person dey make mistake becos i don ready to split my black blood to make sure say i die for positive reasons than to die like a fool,without direction. I be OMOVUDU for my work and ntin dey shake me. I don talk am before and i go repeat am again say His Excellency and he Cabinets nor mean well for Sapele but i stand today point my hand to Governor Emmanuel face say d evil of today against Sapele must bring Glory to Sapele tomorrow. I see a Sapele with Develop Infastructures soon. I see Sapele with many Educational Institutions soon. I see Sapele with NO Electricity failure. etc. I know say many of unu go dey wonder why i dey talk like dis this morning. Make unu nor fear,i norva loose guard mysef and na anger carry me up from grave 208 dis morning becos d Political leaders wey dey Sapele dey chop money dey destroy our hopes but God pass dem. First Governor Emmanuel Uduaghan carry demolishing work give Ministry of Environment and Transportation to demolish d poor people Houses for Sapele. Instead of Ministry Of Land And Survey in colaboration with Town Planning Committee,so dat dem fit use the proper Town Planning rules and dey also dey measure the Houses well before dem demolish the stuctures and instruct the land owners where dem suppose build reach. But dis one na big lie. Wetin concern Environment and Transportation with demolishing? Dis one na d issue of Abino wey go buy bleaching cream. Government without focus. Frm my studio i dey draw my ear dey warn BEDC say dem dey dare Sapele people and we go soon let unu wey dey BEDC know say SAPELE BOMA,JAGUDA never die from our blood. Na maturity nai kpanji dis items from our system and na only oppression nai dey make us bring dem out and with dis new BEDC i promise all say we go show unu d stuff wey Sapele get soon. BEDC na Urhiapele Ameh nai go helep us strike unu wey dey collect money from all the useless names wey dey New Road, starting from Hon. Monday Igbuya wey build Hotel enter Government Road then cum buy Poles to push the HIGH TENSION WIRES AND POLES enter Road. Before all dis miscrants like Hon. Paulinus Akpeki wey nor know e self do e own. Wetin unu dey think sef? Federal Road wey almost all d big and heavy duties vehicles dey pass. After d Engineers with good knowledge don install and plant the poles wit d required meters from the Road. Unu wey be useless cut n nail staff go dey collect money from all dis idiots wey call dem selves Lawmakers and Honourable members wey suppose dey enact and interpret d law,wey nor know themselves so. Unu build unu Houses and Hotel enter Federal Government Road,cum fence the Poles enter unu Houses and Hotel,den now wey dem dey demolish unu dey pay all dis Thiefy Thiefy BEDC workers most especially Engr Orukpe and odas to uproot d poles out from unu compounds den shift am enter Road to cos accident and serve as death trap. Make i tell unu na unu nai go first die for dat trap and i promise unu say na me go be d first person to announce unu death. Unu wen dey demolish wey nor know unu self,atink unu nor dey see the line of d old poles abi? Unu dey do big magomago dey oppress d poor pipo against the rich and i tell unu say the Boy of today go soon become d federal President or Minister tomorrow and e go find all unu Houses and Hotels demolish. And by then wen unu don old na heart attack nai go kill unu. HON. BEN AND FRANK OMARE. Make unu go back to New Rd from Shell Rd junction,make unu go demolish all d structures and fence wey encroach Govt land with d old measurement of the old High Tension poles and make unu clear d road well,fall all d fence wey enter road,not minding who get the land or compound. MOOVIG HOTEL na clear example and i dey urge unu to fall am and even the Govt School Westley,wey unu build e fence cover the High Tension Pole,make unu still pull am down. If unu know say unu nor ready for d demolision den make unu go back go pay compensation give all d affected victims wey unu don destroy deir things. I nor dey talk without proof. My people make unu nor mind my picture quality na Army cos am. Make unu look dis pole wey dey dis picture,e nor near road and i wan ask,nor be fresh sand? Dis na just one. Na me the Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. Hope unu dey clean unu environments? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 28 Jun 2014 07:37:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015