SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dear Deltans Worldwide. I - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dear Deltans Worldwide. I Chief Okpubuluku don waka round all the Major Companies wen dey Sapele and Delta State. I cum see say most of our Children,Brothers,Sisters, Relatives, Fathers and Mothers na few nai get better positions for the Companies wen dey Sapele and other neighbouring Cities. I nor wan call names make e nor be like say i dey expose dem. The last time na from here nai i for complain say na Yoruba pipo,Igbo pipo and other tribes nai dominate d big big Companies wen dey dis our State. Wen i find out say na 1st Class and sharp 2:1 nai dem need and our pipo wen nor make reach dis grade nor dey ever get d opportunity to get employment for all these Companies wen dey our Land and d one wey get Job,either dem put dem for Gate, or Cleaner work or Messanger or Gardener. Na from clap nai dance dey start. Fish nor wear Sweater yet Cool nor fit catch am. I dey here for all unu wen get 2:1 and 2:2 for University and all unu wen get HND Certificate and even ND wen nor wan further again,say d time wen unu go use take dey fear to go Interview for Oil Firms don pass. I don go see say na small thing nai make unu nor dey get better positions, wen mak dem pack our Community boys and girls put for Security, Gardener, Cook,Messanger and Cleaners. And unu go dey answer Yes Sir to unu mates,wen all unu graduate together for unu Fathers Land. E dey pain me becos for our land we nor go fit be slave and we go dey happy say we dey work Oil work,Bitumen Work etc yet we and our mate wen dey dsame Company nor go fit sidon for dsame Hall dey dine wine together,becos deir ranks pass our own. Na small tin nai i want mak unu do and na Level3 of Health Safety and Environmental duties. To some of unu wen nor know about Level3 HSE mak i giv unu small tips. HSE Level 3 na HEALTH SAFETY & ENVIRONMENT. COMPETENCE LEVEL 3, as oyibo call am, na MANAGERIAL COURSE and na for people wen don get their ND,HND or BSC nai go fit do am. D benefit of dis course na; 1. You fit apply for any company as HSE Manager. 2. You fit apply to be an Institute of Safety Professional Of Nigeria (ISPON) member. 3. E go also helep u sustain Job easily wit d help of Safety experience. N.B abeg na two courses nai fit qualifies u for all dis and, d 2 courses na; 1. HSE Level 3 and GHSE nai make i say na only Graduate fit do am (And if u apply now,dem go teach u about am). For the just concluded 3DAYS CONFERENCE wen ISPON dem do for Lagos for Eko Hotel. The person wen President Goodluck Jonathan send go represent himself cum talk for e speech say dem wan put am for Bill for National Assembly say everybody must get H.S.E Certificate before dem go fit employ any graduate for any company. Because Safety na Everyones Responsbity and Company casualties don dey over too high and e dey affect our Growth for our Industries. Wen all dis report reach me,nai i open my Phone Lines call Mr MOSES OGODO wey be SAPELE OKPE COMMUNITY CHAIRMAN. After me and am talk reach wen e fit understand d meaning of watin i dey talk,e cum agree to sponsor 10 PERSONS for a start from Sapele Okpe Community Treasury and me and am agree say for d 10 persons e go choose 4 None Indigens and e go pik 6 Sapele-Okpe indigens at d rate of N35,000 each for HSE Level3. So mak unu wen qualify,go meet Monday Onomor or call am on 08069701566, or meet Solomon Abeke and Moses Ogodo for Okpe Hall or for deir Houses to submit unu names, so dat our leaders go sponsor unu. Also i cum see am say e nor go good mak i nor involve other leaders,so i call MR HENRY EYATAFE the Community Chairman of Ugborhen Community. He cum agree to sponsor any Graduate wen cum from e community and drop e name and qualification proof to e Secretary. So i challenge all unu wen dey mak mouth say unu be Graduate and unu cum from UGBORHEN to go unu Community go drop unu names,as i assure unu say unu Chairman go must register unu for dis program. E nor go good mak we nor call some individuals wen go fit sponsor some persons from our Studio,so i call Omatsan Olololo and e agree to sponsor 3persons from here. Make unu clap for Omatsan Olololo as God don put heart of flesh for e body. Also we call Prince Joseph Asheyinku and we also send am Text Message but e norva respond. I know say e go respond well positively, becos na better tin dem dey support. I call Mr William Alaba Amukpe/ Okuirigwre Community President General but e say we go talk today,mak e see amany pipo wen e go fit sponsor. So unu wen dey dat side make unu go drop unu names wit am. I suppose call Hon. Godwin Ebosa but e nor dey Country as report reach me say e dey U.K with e family as dem go celebrate wit e 2Children wen go graduate on deir First and Second Degree programme (I DEY WAIT UNU,MAK UNU CUM BACK WITH THE CHANGE WEN UNU SPEND REMAIN,BECOS PIPO FULL GROUND WEN NEED UNU HELP). Francis Maku i dey wait u too. Hon. Micheal Diden and all Sapele Political Leaders mak unu dey expect my calls becos Sapele Youths must advance and dem must eat from the Fruits of Sapele Oil and oda beta work wen go cum Sapele and Delta State. For dis Forum i know say people dey wen fit sponsor our Graduates and increase deir chance of securing a beta White Colar Jobs. D good wen we go do today go plant Tree wen go feed crowd tomorrow. I call on anybody wen God touch e heart from dis Forum to atleast sponsor One (1) Person at d rate of N35,000 or more dan one person. We nor need anybody money for our Studio to register any group of person(s). So mak unu wen wan sponsor alert me and mak unu pay directly into d Company Account thru; AIGEDOSIN NIGERIA LIMITED ACC No. 1014375665. UBA Bank. Also if you know say from ur own Account u fit foot ur Bills,kindly call dis numbers below and apply in person 08136853369 08095797222 at d rate of N35K. Also if i mistake see ur name for 2 place,base on say u dey form sharp man,submit for Forum here and u still go Ugborhen and Sapele go submit,nai be say u don use ur hand disqualify ursef,becos all Communities list go pass thru my Studio for Screening befor i go publish d Benefactors. Na make Sapele better and mak our Youths get meaningful existence for a better tomorrow nai we dey fight for. I call on all of us,say mak we try hold on to support Sapele growth,so dat the Community go remember your name for better thing tomorrow,becos u don plant beta Tree. Mak we stop to dey dash our Youths money,mak we put meanings for deir Life,we go see say Crime go reduce,and dem go know d importance of deir relevance for our Society. I challenge all my Friends wen dey Abroad dis nor be Transformer wen unu look throway face,i dare unu to support dis advance movement. (ANNOUNCEMENT ENGR URUKPE DEY RECTIFY HIGH BILL NOW,AS E DON CLAIM SAY NA MISTAKE,SO MAK UNU CARRY UNU BILL GO MEET DEM,MAK DEM FOR TELL UNU D ACTUAL MONEY WEN UNU DEY OWE OR SUPPOSE PAY). Na me the OTOTA1. The Urhukpe of Okpe Kingdom & The Eagle Eyes Of Delta State,nai Drop dis Goods dis Morning. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 20 Nov 2013 04:35:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015