SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dem nor say make pikin nor get - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dem nor say make pikin nor get big teeths but make e get big lips to cover d teeth. My people make we dey see truth dey talk. Nobody go happy say after e born pikin finish,train am reach one extent,den d pikin go come just die like dat. Dat pikin wey DIE for peemos Hotel since on Sunday wen dem cum see for Oghara on Tuesday,na the Family fault. Why unu go dey allow unu Children dey carry waka on Sundays? If pikin hard unu to get,i believe say unu for dey fit dey monitor unu pikin,and unu for know deir value. In those days wen we small,if we go River go baff,na becos say our parents carry clothes come River cum wash,nai go make we near River,due to say na kpako nai i be. I dey vex for d way we dey allow Children dey waka anyhow,and dey even dey allow dem dey enter some kain Hotels for Sapele. D tin dey very wrong. Wen we small we nor fit go Hotel go eat,nor to talk of to go drink,but dis days na so small children go dey pass Bros dem Cigar for Hotel. I dey shame for unu wen dey fool unu selves. Na lack of better attention from the parents nai kpuff dis Boy so,and make d Family just pray say make God forgive dem. Now PEEMOS HOTEL. Major Gen Patrick Aziza Rtd,now Urhobo Progressive Union President. Wetin u think say ur managers dey do for ur Hotel? When i reach unu Hotel make i go comfirm wetin happen,nai i see say unu give instructions say make anybody wen wan swim put on Life Jacket,and unu dey close unu Beach for 5p.m. No drinking for Beach side. And make Nobody cross the signal line.etc. Wit all dis unu many instructions,i see Beer Bottles for d ground of the Beach yesterday,i see say unu dey allow Boys dey smoke Igboo for the ending of the Beach. People dey swim without Life Jacket and unu nor dey care. Unu nor suppose to dey allow pipo dey swim pass unu extreme limit. DIVERS suppose dey duty as far as somebody dey the Water dey swim. If to say unu keep to unu own rules well self,dis small Boy for nor die. Na big warning i dey give unu or else we go close that Hotel down for some time,becos dis nor be d first time dis kind thing dey happen for dis Peemos Hotel. The major reason wey make me dey vex now be say wen person Die for "Point n Kill" dem close am down. Angels Place person die dem still close am down (before dem cum resume again wit anoda business),G-Klass person still die again,unu close am down.etc. PEEMOS,more dan 3 Persons don die now for dis same Peemos Hotel. None of unu fit cross go meet Rtd Major Gen Patrick Aziza to caution dem to improve for deir services. Customers nor suppose to dey swim pass the limit wen unu put for d Hotel. Wen dem tell unu make unu nor dey open Hotel anyhow for Sapele,unu nor dey hear word. Na d standard of Peemos wen dem open am,nai e still dey so? No. Oga Patrick don even tire for d way and manner d place dey go,as e expect more favourable patronage compare to wetin him cum dey see,nai make am waka leave d Hotel,dey go sit down for e Fish Farm with him small Lolipop wey dey helep am dey manage the Bar,and d Fish farm wey dey Okirigwe. The management of Peemos dey very poor and disorganize. Unu nor fit dey pay more dan two DIVERS,so dat dem go dey run shift,and unu dey collect money from pipo after Divers don close,and dey allow pipo still dey swim wen dem nor suppose enter Water again. Unu even small Boat wen unu suppose dey use take dey patrol the water,yet unu just leave all dey spoil and unu nor care. Unu put for unu Hotel and Internet say unu dey run 24Hrs services,but na only Hotel Bookings nai unu dey give dat attention. Na so i cum d Hotel one day after 12 for midnight,unu reception sleep yakata for her Stand,till i shout wake her befor she know say i dey around. Make unu tight unu seat belt becos dat era wen things dey carry happen for Sapele and Nobody dey question unu don pass. Dis warning goes to all other Hotels wen dey Sapele and Delta State,say make unu beef Security and make unu nor dey allow under-age for unu Hotels again. Na here i talk reach dis Morning. (I NEED ALL THE "DELTA CENTRAL SENATORIAL CANDITATES" Phone Numbers. If you get any Inbox me) NA OTOTA OF SAPELE NAI DEY YARN. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 26 Sep 2013 05:24:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015