Snippets of an imaginary literary convo I had with a guy at a - TopicsExpress



          

Snippets of an imaginary literary convo I had with a guy at a joint sometime ago - not really imaginary sha, but too surreal to be real.... Bros: Guy, wetin be di name of di puwem you dey read so? Me: Erm, The Holy Office. Its a poem by James Joyce. Bros: Jame Johns? E be like say na Niger-Delta guy. Me: Erm, ah, something like that. Bros: Oya, wetin the puwem dey tok about nah? Me: Well, the poem is actually... Bros: No tell me! I sabi wetin di poem dey yarn. Me: You do? Bros: Yes nah. Me: Wow. Have you read it before? Bros: No, but I sabi wetin im be about. Me: Really? Bros: Ehe nah. As a real Waffy guy, we no dey kari las for dis kain tins. Me: Okay. Gist me then. Bros: See, di puwem name na Di Holy Office, no be so? Me: Yes, something like that. You could say that sha. Bros: So diafor, e dey tok about all dose pastors wey dey use Jesus name dey open office for pipul head. Me: *open-mouthed shock* Bros: Abi, I get am or I no get am? Me: *closes mouth and composes himself* Well, erm, a poem is subject to diverse interpretations. You could be right, you know. Bros: See nah! Guy, make I te you. I no need read book before I go get im gist. Na only title I go jus read and, bam!, the meaning go jus enta my brain sharpally. Me: Wow, you surely are some gifted guy. I envy your skills. Bros: *proud smile* Well, no be me sha. Na God. Me: Well, dunno if God Himself is qualified enough to claim credit for such a brilliant literary analysis as yours. Just take the credit, man. Bros: If you say so, my guy. *La Fin*
Posted on: Fri, 04 Apr 2014 10:19:23 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015