WAHALA (TROUBLE) is: ~When the person interviewing you at - TopicsExpress



          

WAHALA (TROUBLE) is: ~When the person interviewing you at your new job is the same guy you insulted in traffic {........You go apologisetire.: O} ~When you tell your friend your mama!!! and turn around and see his or her mum staring at you {.........Meeeh n, you go collect plenty slap.} ~When Mosquito lands on your fathers bald head and you try to kill it with your bare hands. {........You must provide the proof ohh!, or else,,,,.} ~When you update salary things on facebook and your landlord commentson point {.........You go travel go villa by force.} ~When you dey on top okada and the okada man dey ping {........Na automaticticket to Baba God be dat.:} ~When you finish eating in an eatery and you find out your wallet fell out in a taxi {......Start to prepare your grammar wey big pass the one of Hon. Patrick.} ~When olympic gold medalist Usain Bolt chases you with a Cutlass {......Olboy, just stop begin beg am sharp! sharp.} ~When you give beggar #5000 note instead of #50.{.....Gener osity go change clubside.} ~When your husband dey play wit you, your pikin shout daddy you no sabi, nobe so gateman dey do am {......you no say water don pass garri} ~When you see your wife for the same hotel you go with your babe {.....O! boy start fast calculations.oO ! Before the situation go resemble BODMAS and CALCULUS} ~When youre in a bus and you throw away #1000 note instead of gala wrapper. {........Olboy , E don red for your eyes be dat! cry} ~When you carry your new girlfriend go Genesis Fast Food in Enugu. She chop pass the money wey you carry, {........ I swear, you go wash plate tire} ~When you lie for girl in a bus say you be army officer, police for check point come ask: IDENTIFY URSELF SIR {......the market wey you buy pass alaba market} ~When you are on a plane and you heard the pilot shouting Oh! my God {..... Na prayer for forgiveness be dat.oOh!} ~When your galfriend enter your room and she discover say pant wey no be her own dey for your drawer {...... Guy, just prepare lies wey win Guinness Book of records else you go wear seatbelt ontop okada.} ~When you mistakenly send the love text meant for your boyfriend to your father {....... Chei! You have serious explanation to do if you no want your papa to forget em hand for your face.} ~When you mistakenly pour dirty water with oil from your upstair and em go splash for soldier men patrol motor {.........hmm! Your own don kpeme be dat cos you go suffer like Damaturu cows.} ~When you dey beside a guy in a commercial bus and he says watch out in the next 30 seconds, the bomb wey I carry go explode.oO!{.. ...... Omo gbege and catastrophy don tie wrapper for you.oO!} ~When your dad works at NEPA and they take light and you shout God punish NEPA and hes there with you {.......Na your mama go start to pay yourschool fees oo
Posted on: Wed, 02 Jul 2014 05:08:37 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015