WEDNESDAY 26TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

WEDNESDAY 26TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOOO.......... .. *No Much News Today* THIS NA OUR CONTACT: 08104854272 Facebook Profile Link : https://m.facebook/profile.php?id=830049580348520 to Follow Us for Ogbonge News Report land our studio say sales of spat form go end dec 15th and the exam go commence january 6th so make una take note say na CBT ooo, #Tafia qo dey dia Live 2days b4 d Exam 2 Train Una 4 CBT Another Report take plane fly enter studio say Spat result don almost ready as na only final year student result dem go paste this month end so make una take note........... We receive report say School of Environmental Studies don enter CAMPUS 3 Lecture don Start for all NDI student, since Last week as their Timetable don Show face Report reach Us say that List wey dem release Last week for ND nor be Supplementary, na 4th Batch. Supplementary qo soon Show face but nor be for NOTICE BOARD dem qo Paste am, na for Hod of d Dept notice board dem qo Use,, If e cum Out we qo Hala Una.. fight nearly happen for UBA BANK today for wia Student dey struggle to follow Line (SPAT) Regular ND FINAL wey qo for him 4 Months SIWES Banking and Finance for Asahaba, (Name Witheld), we hear say e go the Company wey e for the do I.T go steal the White man Phone, dem never see am up till nw, but I Know U, resume 1st... Report land Our Studio say FIDELITY BANK dey close 1Pm and some student dey travel Back witout Payinq d School fees, abeg make Una do somethinq to dat Mata abeg.. To doz of Una wey dey hold Our Balance afta Una don see Una names for admission List, I swear 2 God, make Una nor try Resume oo bcos I go enta Una *PLAIN* Report reach us say the National I.D card wen dem dey do for CEDAP for campus 2 don dey cause trouble as anytime wen people go there dem go say them don take names finish for the day, hmmm abeg make Una do Somethinq to dat one.. If U cum Auchi New and U need who go help U do some tinx, hala Us, we go send one of Our STAFF for U, dem dey at Ur service, we qo Student Hotel (Small Room).. FG don add more 2yrs for Our Rector to carry One with her Ogbonge Work, I know say AUCHI EDO STATE GO BETA.. To the HND,, we qo talk put wit Management today so we go Know wen the Last batch go show.. This People say make I trow Una Greetings and Make I Welcome Una to CamPus and dey wish Una StressFree Semester *9Ice (SUG President) *Testimony (Vice SUG president) *Beta Pikin (DOS) *Buchi *Rasheeda Restaurant *And Special Adviser to the Governor of Edo State on Public Relation wey call Us Yesterday say him dey Enjoy Our Work Make una take note say we don join alliance with some of our news presenters to make sure say Auchi poly students no lack news this holiday period and this na their names 1. #Auchi_Poly_Ajaz eera 2 #Tatafo_Junior formal known as #Wap_Junior 3 #Auchipoly_Rambo 4. #Auchi_Poly_Tafi a_Reloaded If you get any problem you fit tell any of us as we go treat am 1 time. Make una still take note say we don get page as our page now na AUCHI POLY TAFIA https://m.facebook/profile.php?id=830049580348520 so make una go LIKE am now oo........ Abeg If U get any Ambition for SUG POLITICS, let Us Know, we go Screen U and Help U qet wat U knw if U pass Our Screeninq bcos we need beta Leader for AUCHI POLY THIS NA OUR CONTACTS: 08104854272 Facebook Profile Link : https://m.facebook/profile.php?id=830049580348520 AUCHI POLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D MOUTHPIST OF AUCHIPOLY D TATAFO OF AUCHIPOLY D AMEBO OF AUCHI POLY D EAGLES EYE OF AUCHIPOLY Nai dey give una this tory. Abeg make I go DESTINY LODGE for Tomorrow News, una bye bye. THIS NA OUR CONTACT: 08104854272
Posted on: Wed, 26 Nov 2014 04:12:25 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015