1. The Lord na my shephard, i dey kampe. 2. E make me sidon for - TopicsExpress



          

1. The Lord na my shephard, i dey kampe. 2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool. 3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead medey go through express road of righteousness sake of Hin name. 4. Walahi !, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reachvalley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem deylike back bone dey comfort me. 5. You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All maienemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank. 6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO AMEN.coded@HOLUMIDEH
Posted on: Fri, 28 Jun 2013 21:11:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015