99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Make We Check Am: For inside Ekiti State, - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Make We Check Am: For inside Ekiti State, nothing less than 70 landlords naim dem arrest for inside the last two months sake of say dem bin nor provide toilet for inside the house wey dem get tenants. Nah the Director of Environmental & Sanitation, Mr. Tunde Balogun bin carry dis gist news people for inside Ado-Ekiti for lastweek Friday & say dis wan wey the landlords do so dey against the ammended Ekiti State Environmental and Sanitation Law, 2004 and the Environmental Regulations 2009, wey Ministry of Environment bin don yarn say nah "One House, One Toilet". The Director yarn join say dem go continue to dey arrest landlord dem wey dey default the law... Bigmo (@bigmoNaija) dey ask how u take check dis matter? #UnaWakeUpShow #TearRubberWeek #WhoSabiPass Tel: 094-600-995 Twitter: @Wazobia_Fm wazobiafm
Posted on: Mon, 09 Sep 2013 08:15:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015