99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: The Lagos State Police - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: Tori For Town: The Lagos State Police Command don arrest one 36 years old man, Daniel Kanjo, sake say im kpai im 24years old wife, Meno Kanjo, inside Elemoro, Ajah area of the state. According to police torchlightment, Daniel bin stab im wife till she kpai after im catch her dey do minimini wanawana with anoda man inside bush wey near dem house, one police person for Elemoro Divison, yarn say after Daniel bin stab im wife many times, na so imsef come stab imsef for stomach and neck. Wen people reach dere, dem bin think say the man and im wife don kpai, naim dem come call police to come carry the man wit im wife deadbodi. As dem come dey carry the two deadbodi na so dem notice say Daniel still dey breath, naim dem rush am go hospital for treatment… Hmmm!!! Bigmo (@bigmoNaija) & Yaksman dey ask wetin u for do, if nah u be dis man wey catch im wife wit anoda man dey do minimini wanawana for bush? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #WonderfulWednesday Twitter: @Wazobia_FM Tel: 094-600-995 wazobiafm
Posted on: Wed, 19 Jun 2013 05:30:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015