ABEG NO LAUGH BKOS I SERIOUS, kos I just need ur advise... My - TopicsExpress



          

ABEG NO LAUGH BKOS I SERIOUS, kos I just need ur advise... My Blackberry don chop my money tire, na him I come vex yestaday sell am, come take some money buy China phone! Now am in bigger trouble!!! 1. E go full after 3 minutes of charging. 2. The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Fire-lighter, torch etc. 3. I fit write Text message with toothpick sef. 4. The spellings get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon, samswag etc. 5. When aeroplane pass e go record One missed Call. 6. When a big car horn; e go show Charger connected 7. When Chinese man pass e go show: One Bluetooth device found 8. When fine lady waka pass, e go show WiFi On 9. When ugly lady waka pass, e go show, Virus detected Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer, e dey show me for screen say No contact found.
Posted on: Wed, 10 Sep 2014 07:30:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015