AKPORS THE CHURCH INTERPRETER Pastor: As it is written in the - TopicsExpress



          

AKPORS THE CHURCH INTERPRETER Pastor: As it is written in the bible Akpors: As dem yan 4 bible Pastor: Jesus entered the boat with this disciples! Akpors: Bros J cum enta canoe with im padi dem! Pastor : As the boat was sailing,there was a great storm! Akpors: As the canoe dey move na im yawa cum gas! Pastor: The storm was so great with it was like a whirlwind! Akpors: As the yawa dey gas na im kasala bust join! Pastor: The disciple became so afraid and they shouted Master! Master! Akpors: Na im live fail 4 im padi dem, na im dem begin dey hala Bros eh! Bros eh!. Pastor: Jesus got up and calmed down the wind! Akpors: Na so bros J get up kon arrange the mata! Pastor:. He turned to his disciples and said oh ye with little faith! Akpors: Na im bros J luk im padi dem shake im head kon provoke “O BOI! Una fall ma hand oo! Pastor: The disciples replied and said what MANNER of man is this? Akpors:. Im padi dem kon hala. “SHOO” bros J which level nan! U BE WINSH You guys should hail Akpors ooo, abi im no try?
Posted on: Thu, 24 Apr 2014 16:30:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015